Court dismiss police application to arraign Seun Kuti

Seun Kuti and wife for court

BBC
Seun Kuti and wife for court

One Magistrate Court on Wednesday dismiss application wey di Nigeria police force file to arraign Nigerian Afrobeats singer, Seun Kuti.

Di musician show for di chief Magistrate’s court Yaba area of Lagos State, afta court order make dem release am on bail from di state criminal investigative department Panti on Tuesday 23 May.

Police bin arrest Oga Kuti ontop accuse say e assault one police officer ontop Third Mainland bridge Lagos.

Di video of di assault wey show am slap di officer inside traffic go viral on social media.

E no too clear wetin cause di wahala but for one Instagram post, Oga Kuti claim say di officer bin wan ”kill me and my family”.

For di hearing resumption, police counsel Cyril Ejiofor ask for leave of court to arraign di singer, as dem don prepare charges against am.

But senior advocate of Nigeria, Femi Falana wey dey represent di defendant ask di court to dismiss di application

Im argument na say maintaining dat kain action of di police amounts to contempt of court.

Adeola Olatunbosun wey be Chief Magistrate adjourn di hearing to Monday 3 July.

Di adjourn date na to give court time to wait for legal advice from di office of di Directorate of Public Prosecutions.

Seun Kuti and Femi Falana for court

BBC
Ogbonge lawyer, Femi Falana go defend Kuti for court

Duplicate case file

Last week, di same court bin don deliver two rulings wey order make di police duplicate di case file.

Afta wen dem go forward am to di Office of di DPP for di Lagos ministry of Justice for advice on whether to prosecute di case.

Di court bin also rule say di police no fit investigate and prosecute di mata

But di police counsel Ejiofor ask di court to dismiss objection say di section 23 of di police Act give dem power to prosecute cases.

E add say di Nigeria police no fit wait for di state goment, as dey don already send di case file to dem.

For her ruling, di magistrate tok say she go tanda by her previous orders to await for di DPP advice.

Timeline of Seun Kuti arrest

Police bin place Nigerian Afrobeat singer, Seun Kuti under arrest for 13 May.

Di Inspector General of police order im arrest afta ove viral video show am dey slap police officer.

Im turn imself in to di police on Monday 15 May.

Since den, di mata don dey court.

But police no gree release di popular musician wey im fans say suppose dey tour by now but ghatz cancel sake of dis mata.

Di mata suppose hold on 23 May but dem move am to Wednesday 24 May 2023.

Dis bw sake of say Justice Adeola Olatubosun of di Chief Magistrates Court for Yaba, Lagos State, wey dey incharge of di mata no dey available.

On Tuesday 23 May, supporters of di popular Musician Seun Kuti gada for Yaba Magistrate Court to protest im arrest.

Di court suppose hear im case on Tuesday 23 May 2023 but di judge wey dey in charge no show.