Madagascar coronavirus cure: Meet di man and kontri wey dey try ‘save’ Africa

For time wey di World dey look for answer to di global coronavirus pandemic, one kontri leader don dey di forefront of di battle.

Madagascar President Andry Rajoelina don catch di world attention wit im ‘herbal drink’ wey im say dey cure coronavirus.

Although di World Health Organization – WHO don warn say di drink need further testing, some African kontris don begin enter queue to order am to test.

On 8 April, president Rajoelina announce to di world di “medicinal plant” wey go see Madagascar” change di course of history” sake of im discovery.

Despite wetin WHO tok, Rajoelina say pipo wey dey criticize im solution to coronavirus dey show di West attitude towards tins wey come from Africa.

Im say “If e be say na European kontri actually discover dis remedy, so much doubt go dey? I no tink so.”

President Andry Rajoelina for one ceremony to launch Covid Organics for Antananarivo - 20 April 2020

AFP
President Rajoelina launch Covid Organics wey im say fit cure coronavirus

Who be Andry Rajoelina?

46-years-old Rajoelina na long time businessman and na one-time Disk Jokey alias DJ.

Im enter politics for 2007 wen im contest to be Mayor of Madagascar capital, Antananarivo.

Rajoelina na di 7th president of di island nation, im don marry and get three children.

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC

Wetin you suppose know about Madagascar

  • Madagascar na di fourth largest island for di world after Greenland, New Guinea and Borneo.
  • Di kontri get population of ova 26 million pipo according to informate from di World Bank.
  • According to di United Nations Office on Drugs and Crime, almost one in 10 Malagasies dey smoke weed.
  • Madagascar currency name na Malagasy Ariary and for today market, one Ariary dey equal to $3,827.
  • Di French na dem colonize Madagascar, di kontri gain independence on June 26, 1960.