Prof Ibrahim Gambari don replace Abba Kyari as President Buhari new Chief of Staff

Nigeria president Muhammadu Buhari on Wednesday reveal Professor Ibrahim Gambari as im new chief of staff.

Prof. Gambari replace Oga Abba Kyari wey im name trend ontop Nigerian social media websites for almost one week afta di goment announce im death on 17 April, 2020.

Secretary to di Goment of di Federation Boss Mustapha na im announce di appointment as di Federal Executive Council wan start on 13 May, 2020.

Ibrahim Gambari

Getty Images
Prof. Gambari na ogbonge scholar-diplomat wey don hold top-top positions for United Nations

Dis na wetin you suppose know about Professor Ibrahim Gambari

Prof. Ibrahim Agboola Gambari i na ogbonge scholar-diplomat wey don hold top-top positions for di joinbodi, according to informate wey United Nations put ontop dia website.

Make we torchlight who di Prof be.

  • Dem born am for 1944, for Ilorin, Kwara State, north central Nigeria.
  • Gambari attend King’s College, Lagos. Im come later attend London School of Economics wia im get im B.Sc. (Economics) degree for (1968) wit specialization in International Relations.
  • Im later collect M.A. (1970) and Ph. D. (1974) degrees from Columbia University, New York, USA in Political Science /International Relations.
  • Prof. bin teach for Ahmadu Bello University, Zaria, Kaduna State 1977 to 1980.
  • First UN Under-Secretary General and Special Adviser to di Secretary-General on Africa.
  • Oga Gambari become Nigeria Minister of External Affairs between 1984 and 1985.
  • E also become Ambassador and Permanent Representative of Nigeria to di United Nations 1990 to 1999.
  • President of di Executive Board of UNICEF in 1999.
  • Head of di UN and AU Hybrid Mission for Darfur (UNAMID) from January 2010 to July 2012.
  • President Jacob Zuma award am South Africa highest honour for non-citizens for October 2012.
  • Na him be di first chancellor of di Kwara State University for 2013.
  • Im na di founder of ogbonge research organisation; Savannah Centre for Abuja.
Ibrahim Gambari

Getty Images
Gambari serve as UN Joint Special Representative, for Darfur

Some of di names wey don come up before as replacement to oga Kyari na pipo like Babagana Kingibe, Adamu Adamu, Hameed Ali and even di current Kaduna governor Nasir el-Rufai.