Who be Aigboje Aig-Imoukhuede wey get ogbonge re-appointment for Access Holdings

Access Holdings Plc don announce Aigboje Aig-Imoukhuede as dia Non-Executive Chairman.

Aig-Imoukhuede dey replace oga Abubakar Jimoh wey bin hold di position bifor.

Oga Jimoh go now kontinu to serve on di Board as Independent Non-Executive Director.

Access Holdings Plc wey pipo sabi as Holdco make di decision afta di completion of di burial of di former Group Chief Executive Officer, Late Herbert Wigwe.

“Access Holdings Plc dey announce di Return of oga Aigboje Aig-Imoukhuede (pioneer Access Bank Group Managing Director/CEO as Holdco chairman afta 10 Years),” di company secretary Sunday Ekwochi tok for statement e sign on Wednesday.

Dis na di second major appointment wey di bank dey make since afta di tragic incident – wia ogbonge Nigerian banker Herbert Wigwe, im wife Chizoba and im son Chizi die for helicopter crash for USA in February.

Access Holdings Plc bin appoint Ms Bolaji Agbede as dia new Group Chief Executive Officer three days afta di crash.

Profile: Aigboje Aig-Imoukhuede

Oga Aigboje Aig-Imoukhuede na Nigeria investor, banker and philanthropist.

E be co-founder of di Tengen Family Office, wia e dey oversee multibillion-dollar portfolio of investments wey include banking, finance, insurance, technology, real estate and energy.

Aig-Imoukhuede career for banking and finance span three decades and e earn am international recognition.

E become group managing director and chief executive officer of Access Bank from 2002, and lead di bank transformation from a minor player into one of di kontri top five banks, wey get presence in nine oda African kontris plus di United Kingdom.

Aigboje believe say strong financial markets and sustainable business practices dey necessary for national development. As member of Nigeria Banker’s Committee, for 2012 e lead di banking sector voluntary adoption of di Nigerian Sustainable Banking Principles.

E retire as CEO for 2013, come open Coronation ecosystem, one unified financial services platform wey e establish through di Coronation Capital Cornerstone Fund. Di ecosystem consist of “long money” financial service businesses wey dey operate for Nigeria and Ghana.

Oga Aig-Imoukhuede na di Chairman of di Board of Trustees of di Financial Market Dealers Association (FMDA) and di founding Chairman of di FMDQ Securities Exchange.

E dey elected Council President of di Nigerian Stock Exchange for 2013, wey make am become di first African to chair two national exchange platforms.

For 2012, dem appoint Mr Aig-Imoukhuede as di Chairman of di Presidential Committee on di Verification of Fuel Subsidies. E say many pipo hail di way e take carry out di process as e save Nigeria billions of dollars in fraudulent fuel subsidy payments.

E get law degree from di University of Benin. E also get Trium MBA.

Source