Denmark vs Tunisia- Follow live text here

Denmark vs Tunisia dey go on

Getty Images

Denmark manager Kasper Hjulmand say dia “dream na to win sometin” but im admit say dem ” no be favourites” for di World Cup for Qatar.

Dia best performance na for 1998, wen dem reach di quarter finals.

Denmark dey Group D wit holders France, Australia and Tunisia, wey dem go play for dia first match on Tuesday

Hjulmand say: “Dis group of players get di quality to win eviritin. We be favourites? No.”

Denmark vs Tunisia as e dey happun

SECOND HALF

47 mins: Di corner target Msakni, im flick di ball out for a goal-kick.

46 mins: Great start from Tunisia. Drager run down di right to cross but e dey blocked.

46 mins: Tunisia kick off di second half.

Kick-Off!

FIRST – HALF

45 + 5 mins: HALF-TIME!

Denmark 0-0 Tunisia

45+ 4 mins: Eriksen look for Andersen wit di corner, but Abdi head am out.

45 + 4mins: Eriksen and Olsen stand ova am. Olsen take am, Meriah clear am out for corner.

45 + 3 mins: Free-kick to Denmark for crossing position.

45′ + 1 mins: Delaney dey waka one kain e no fit continue. Dem replace am wit  Damsgaard for midfield. Im injury come afta Msakni tackle am.

43 mins: Schmeichel punch away di ball from corner kick before Skhiri hit am ova from outside di box.

43 mins: SAVE!

Na correct stop from Schmeichel. One-on-one, Jebali chip but keeper flick am ova.

42 mins- Hojbjerg bin think say im don win penalty afta Laidouni push am comot from di ball. E raise im hands up, but di referee say na goal-kick and di match continue.

40 mins: Kristensen run down di right as im dey look to collect Olsen pass, but e go out for a goal-kick.

39 mins: Slimane corner from di right bounce around di box before Laidouni shoot wide from a tight angle.

38 mins: Jebali do well to win corner. Nobody dey Denmark box, im hold di ball before im hit am against Kjaer.

37 mins: Laidouni dribble past a number of Demark defenders as Tunisia players dey run forward. but, im pass no make sense.

33 mins: Msakni collect di ball around halfway, e find Slimane wey enta di box. E cut inside, but Hojbjerg tackle di Tunisian.

31 mins: Kjaer pick out Olsen wey bin dey run behind di Tunisia defence. One-on-one for di right of di box, Abdi block di ball.

30 mins: Delaney burst down di right and look to pass di ball towards Kristensen wey move inside, but Tunisia player block di pass.

28 mins: Kristensen curl di ball from di right straight for di hands of Dahmen. Na poor cross and wasted chance for Denmark wey dey struggle for dia attack so far.

26 mins: Denmark 0-0 Tunisia

24 mins: Kristensen collect yellow card afta a late challenge on Laidouni.

24 mins: Jebali score, but na offside.

24 mins: Yellow Card for Rasmus Nissen Kristensen

22 mins: Di ball dey bounce around di box, e reach Andersen wey kick shot to Dahmen.

20: Eriksen play corner from di right to Andersen, but im header dey cleared.

19 mins: Denmark dey look to slow di game down as di ball comot for pitch, but Tunisia still dey ginger dem.

18 mins: Laidouni try to chip di ball forward to Slimane, but Christensen come across and pass di ball back to Schmeichel.

16 mins: Denmark go for corner, but e no work. Talbi block Kristensen cross, di ball touch di Leeds man and go out for a goal-kick.

14 mins: Tunisia don fail to keep a clean sheet in 14 of dia 15 games for di World Cup (dem concede 25 goals), di only exception na against West Germany for 1978 (0-0). So far, dia defence no dey under pressure.

12 mins: From di corner, Msakni flick di ball ova di bar for di near post.

11 mins: WIDE! Tunisia go close. Drager shot from di edge deflects off of Christensen and go wide.

10 mins: Schmeichel get di ball for di edge of im own box and move forwards wit am im no dey under no pressure. E take im time, play di ball out as im look for Olsen for di right.

8 mins: Tunisia dey play well so far. Dem dey pass ball around confidently and dey look attack Denmark wit every opportunity.

7 mins: Dahmen hit di ball down di field to find Jebali, but Kjaer run forward to clears am away.

5 mins: Jebali win di ball off of Christensen wey bin dey try to let the ball roll out for a goal-kick.

4 mins: Di game don stop Christensen need attention. Im block one hot shot from Msakni, but im dey fine to continue.

2 mins: Eriksen corner from di right side dem clear am. Di Manchester United man gets di ball on di right but Laidouni tackle am. Di Tunisian player come hit im chest and celebrate di clearance.

Denmark 0-0 Tunisia

1 min: Denmark kick off di game

Team News

Denmark Frederik Ronnow bin miss Union Berlin final three Bundesliga matches wit a hamstring injury.

Wolfsburg forward Jonas Wind also na doubt wit a muscle issue.

Tunisia captain Youssef Msakni bin miss di 2018 World Cup wit injury and im don struggle wit injury again for di build-up to Qatar – but im dey expected to dey fit to face Denmark.

MATCH FACTS- Head to head

Tunisia

Getty Images

Dis na di first encounter between Denmark and Tunisia for di World Cup.

Dia only previous meeting na for friendly 20 years ago for Japan, before di 2002 tournament, wey Denmark win 2-1.

Denmark dey unbeaten against African opposition for World Cup (W2, D2), while Tunisia neva win against European opposition for di tournament (D3, L7).

Denmark line up

1 Schmeichel

2 Andersen

4 Kjaer

6 Christensen

13 Kristensen

23 Højbjerg

8 Delaney

10 Eriksen

5 Maehle

11 Skov Olsen

12 Dolberg

Substitutes

3 Nelsson

7 Jensen

9 Braithwaite

14 Damsgaard

15 Nørgaard

16 Christensen

17 Stryger Larsen

18 Wass

19 Wind

20 Poulsen

21 Cornelius

22 Rønnow

24 Skov

25 Lindstrøm

26 Bah 

Tunisia line up

16 Dahmen

3 Talbi

6 Bronn

4 Meriah

20 Dräger

14 Laïdouni

17 Skhiri

24 Abdi

25 Ben Slimane

7 Msakni

9 Jebali

Substitutes

1 Mathlouthi

2 Ifa

5 Ghandri

8 Mejbri

10 Khazri

11 Khenissi

12 Maâloul

13 Sassi

15 Ben Romdhane

18 Chaalali

19 Jaziri

21 Kechrida

22 Ben Saïd

23 Sliti

26 Hassen

 

Referee:

César Arturo Ramos Palazuelos