Magu suspension: Muhammed Umar go take charge of EFCC as per Buhari order

Nigeria President Muhammadu Buhari don confam di suspension of Ibrahim Magu as di acting Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC)

Dis na as im dey ansa case ontop accuse of misconduct.

Magu suspension by di president wey be with immediate effect come inside announcement on Friday from di office of di Attorney-General of di federation and Minister of Justice.

Di statement also direct di EFCC Director of Operations, Mohammed Umar, to take charge and oversee di activities of di commission.

Wetin be di accuse against Magu?

One presidential panel dey investigate di activities of di agency under di administration of Magu wey reports don dey detention since on Monday.

According to tori, dis one dey come afta accuse of misconduct against am from di Attorney-General of di federation, Abubakar Malami.

Malami bin write to Buhari, to ask make dem comot Magu as di acting chair of di anti-graft agency.

Di Panel wey former President of di court of appeal Ayo Salami dey lead bin invite Magu to hear im own side regarding wetin dem dey accuse am and how e dey run EFCC.