‘Na di will of Allah’ – Maryam Shetty tok after Tinubu withdraw her ministerial nomination

Na di season for di appointment of ministers wey go serve wit Nigeria newly elected president, Bola Ahmed Tinubu and na so different kain drama dey show as di kontri Senate continue to screen di ministers.

Latest drama wey make social media catch fire na Maryam Shetty from Kano state, wey di president remove from di ministerial list, replace her wit anoda woman, Mariya Mahmud.

For Tinubu letter wey Senate President Godswill Akpabio read for plenary, di president withdraw nomination of Shetty.

Di president for di same letter list former minister of state for labour and employment, Festus Keyamo name for di nomination.

Dis latest development make Nigerians para for social media.

Although e neva clear wetin exactly, make di president remove Shetty, so Nigerians believe say e fit be sake of say she dance for TikTok.

Tori wey BBC neva fit confam, allege say petitions bin don dey fly upanda inside APC leadership unto why dem give her di appointment.

While Shetty removal be like di highest drama so far for dis ministerial list mata, some oda kain drama bin don occur since screening begin on Monday.

So many tins happun since di ministerial appointment list of president Tinubu emerge.

From di first list wey get di name of opposition member, Nyesom Wike of di Peoples Democratic Party to di appointment of 36 years of Betta Edu den Nasir El-Rufai of Kaduna state – many tins happun since oga Tinubu send dat list.

This na some of drama dem wey happun;

‘Na di divine will of Allah’

Maryam Shetty on 5 August via her verified Facebook page react to di withdrawal as she describe am as di divine will of Allah.

“I see am as di divine will of Allah, wey I believe grant power as im wish, wen im wish. Im plans always dey superior to our own,” she tok.

Shetty wey tok say di nomination bring am honour assure her followers say dis withdrawal no shake am as she fit still come back.

She say wen di president nominate am, na validation of her capabilities and sign say Nigeria don readi to embrace future where young women fit hold position of influence and power.

“Di dream still dey alive, and my commitment to our nation still dey kanpe.

“As we move forward, I pray for di good health and strength of our President Baba Bola Ahmed Tinubu and his Vice President, Sen. Kashim Shettima,” she tok.

El-Rufai screening

On Tuesday 1 August, na so drama begin wen Senate start to screen former Kaduna State govnor, Nasir el-Rufai.

Senator Sunday Karimi argue say e get petition against El-Rufai wey say make dem stop im screening ontop insecurity mata.

Karimi bin ask for permission to read di petition against di govnor, wey im bin carry for one brown envelop, about di insecurity wey bin worry for Southern Kaduna wen im be govnor.

But im fellow senators refuse am as all of dem bin shout “no, no, no,” and di Senate President stop am, come ask El-Rufai to “please take a bow and go, my broad.”

Doris Uzoka-Anite

Wahala wear trouser as ministerial nominee from Imo state, Doris Uzoka-Anite, no gree ok anytin about husband, children and family during her screening.

Di Senate president bin raise observation say e be like di CV wey dem give about her no complete as im no see anytin wey concern her papa, mama and community, come ask her make she tok about dem.

For her response, she tok about her grandpapa, but no say anytin about husband, and for children she say she get dem plenty plus including di one wey she born and di one wey she no born.