Tinubu, oda African leaders mourn wit Namibia as President Hage Geingob die age 82

Di President of di Republic of Namibia, Hage Geingob, don die at di age of 82.

Mangolo Mbumba wey be di acting president make di announcement inside one statement on Sunday.

President Geingob die Sunday 4 February 2024, around midnight for Lady Pohamba Hospital, Windhoek, for di capital of Namibia.

“Na wit heavy sadness and regret I dey take inform you say our beloved, di President of di Republic of Namibia don die today, Sunday 4 February 2024 around 00h04 for Lady Pohamba Hospital wia im bin dey receive treatment from im medical team. Im dear wife Madame Monica Geingos and im children bin dey by inside.

Geingob bin dey receive treatment for cancer afta doctors find out during one routine medical check-up.

In office bin announce say im go travel go US for treatment, but say im go return to Namibia on 2 February.

Im bin do one aortic operation last year, and for 2014 in reveal say im bin survive prostate cancer.

Mbumba describe di late president as veri important pesin for Namibia politics, “a liberation struggle icon, di chief architect of our constitution and di pillar of di Namibian house.”

African leaders mourn wit Namibia

Different kontris don send condolence messages give Namibia sake of di death of President Geingob.

Nigeria President Bola Tinubu for im condolence message wey im send on behalf of im goment and pipo to Namibia, e say Geingob die for critical time wey Africa bin need “more leaders wey sabi, wey believe in di common destiny of Africa”.

E add say di late president na pesin wey bin fit build and maintain connections wit different kontris.

Kenya President William Ruto don order make dem fly im kontri flag on half-mast in salute to di ogbonge Africa leader President Geingob.

For im condolence speech wey im post for X social media, e say Geingob na “believer in united Africa and im bin strongly promote di continent voice plus make am dey noticeable for international arena.”

President Cyril Ramaphosa of South Africa, for im condolence message say, “President Geingob na towering veteran of Namibia freedom from colonialism and apartheid”.

Hakainde Hichilema, President of Republic of Zambia, for im condolence message for X, say: “We don lost a great African statesman, true friend and elder brother.”

President of Zimbabwe, Emmerson Mnangagwa, say “dem go remember President Geingob leadership and resilience”.

From United Republic of Tanzania, President Samia Suluhu, describe di late president as “Pan Africanist and great friend of Tanzania,” as she send her condolence message give im wife and children.

Many oda powerful African leaders also send dia condolences.

Dem include former Kenya President Uhuru Kenyatta wey say: “Words no dey to take explain dis kain loss as President Geingob na ogbonge servant of di pipo, excellent statesman and great leader full of wisdom.”

Hage Geingob profile

Dem born Hage Gottfried Geingob on August 3, 1941.

Geingob na ogbonge Namibia politician wey serve as di number three president of di kontri from March 21, 2015 until im die recently.

For im political journey im bin hold veri important positions:

Prime minister of Namibia (1990-2002): Geingob hold di position of Namibia first Prime Minister afta di kontri independence or 1990.

During dis period, im leadership help to shape di kontri early years.

Second term as prime minister (2012-2015): Geingob return to position of prime minister from 2012 to 2015.

During dis time im continue to contribute to Namibia goment and development.

Presidential tenure: Geingob become president for 2015 and im bin dey serve im second and final term for office.

As president, im lead Namibia through two terms for office.

Im goment focus on different tins, including economic growth, social welfare, and international relations.

Namibia dey ready for presidential and parliamentary elections for November.

Di ruling Swapo party, wey don dey power since independence for 1990, don choose Madam Nandi-Ndaitwah as im presidential candidate.

Currently she also be one of Namibia deputy prime ministers, and go become di kontri first female president if she win.

Source