How pulling out of Ecowas go take affect Mali, Niger, Burkina Faso

Burkina Faso security and intelligence services

Getty Images

West Africa kontris Burkina Faso, Niger Republic and Mali don announce say dem don comot from di Economic Community of West Africa States (Ecowas).

Dem announce say dem dey pull-out from di regional union inside one joint statement wey dem release on Sunday 28 January, 2024.

Dem also read out di communique ontop Niger Republic National Television.

Leaders of di three Sahel kontris for dia joint statement say na dia “sovereign decision” to comot from di Economic Community of West African States “without delay”.

Di three kontris for inside dia joint statement say dem dey pull-out sake of say di way wey Ecowas dey now, no be wetin di founding fathers bin want wen dem create am.

Dem add say di union don comot from di original plan wey di founding fathers bin get and na why dem decide to comot as sovereign nations.

“Afta 49 years, di valiant peoples of Burkina Faso, Mali, and Niger regret and wit great disappointment observe say di (Ecowas) organization don drift from di ideals of di founding fathers and di spirit of Pan-Africanism,” Colonel Amadou Abdramane, Niger junta tok-tok pesin tok inside di statement.

“Di organization notably fail to assist diz states for dia existential fight against terrorism and insecurity,” Abdramane add.

For September 2023, di three kontris sign one mutual defence pact to support one anoda against armed rebellion or external aggression.

Di charter – wey be di Alliance (collabo) of di Sahel States – bind di kontris to assist one anoda.

Dis collabo also include dia military incase of any attack against one of dem.

Ecowas bin impose economic sanctions and suspend di three kontris afta di military seize power inside plenty series of coups, wey increase di political tension for di Sahel.

Dia withdrawal from Ecowas dey expected to further frustrate di demand wey di West African leaders dey make to hand over power to civilians for elections wey dey expected to happun later dis year.

Ecowas tok say dem neva receive any official notification from Niger, Mali and Burkina Faso say dem don comot from di African bloc.

“Di commission neva receive any direct formal notification from di three member states about dia intention to withdraw from our community,” Ecowas tok for statement.

Dem add say dem bin don dey work well well wit dis kontris to restore constitutional order.

“Burkina Faso, Niger and Mali still be important members of di community and di Authority still dey committed to find a negotiated solution to di political kasala”

Ecowas say dem go tok more as tins develop.

Wetin e mean to pull-out from Ecowas?

Former Nigeria presidential aide Tolu Ogunlesi don chook mouth inside dis Ecowas kasala wit Niger, Burkina Faso and Mali.

For im post on X im explain wetin e mean to comot or withdraw from Ecowas.

According to am, e mean say “ Dem go lose access to di Ecowas Passport regime, wey guarantee visa-free travel within di bloc.

Dis three kontris dey locked by land, wey mean even further isolation.”

For im post im explain say no be di first time wey kontris dey comot from Ecowas.

“Mauritania quit for December 2000, afta dem give one-year notice for December 1999.

“I believe say dem quit so dem fit concentrate on forging deeper ties wit di North African kontris of Libya, Algeria and Morocco.

“Two decades later, December 2019, Mauritania come back (e be like) to sign a Partnership Agreement (wey cover trade and migration) wit Ecowas”, Im add.

Source