Who go be Ondo state govnor next afta Akeredolu death

Wia vacancy dey for di office of di govnor as a result of death, di deputy govnor go take ova di govnorship seat in accordance wit di constitution.

Dis one mean say following tori of di death of di Ondo state govnor, Rotimi Akeredolu, im deputy, Lucky Aiyedatiwa go dey sworn in as govnor any moment from now.

One constitutional lawyer, Festus Ogun wey follow BBC Pidgin tok say Section 191 (1) of di 1999 Constitution state say dem go immediately swear in di deputy. E say di operative word “shall” for di constitution, no give room for delay or discretion. “E command mandatory”, e tok.

Oga Ogun add say afta Aiyedatiwa take im oath of office as govnor, e go nominate a new deputy govnor wey go dey subject to approval by di State House of Assembly.

Meanwhile, tributes don dey pour in for di late governor wey die for office.

Chairman of di Nigeria Governor’s Forum, Abdulrahman Abdulrazak wey also be di govnor of Kwara state express im sadness on di death and describe di late Akeredolu as an exceptional statesman wey make ogbonge marks for public service.

Oda govnors and politicians also don begin express dia condolences on di passing of di great political icon.

67-year-old Akeredolu bin battle wit health challenge before im death. E bin take sick leave for months to go for medical treatment abroad.

Dem first fly Aketi as many pipo dey fondly call am go abroad for treatment for June. E return back for September and say im still dey recover and dey get beta. E post for Facebook say ‘I am back’.

Afta im return, reports say e stay for Ibadan, Oyo state capital, south-west Nigeria instead of im state, Ondo, dis one bin raise plenty eye brow and raise public concerns on di state of di health of Govnor Akeredolu.

Oda Nigerian political leaders wey die for office

Former Nigeria president Umar Yar'Adua

Getty Images

Dis no be di first time wey govnor or president go die for office for Nigeria.

One former Nigeria President, Umar Yar’Adua also die for office for May 2010 at di age of 58.

Dem interrupt one Nigerian national television broadcast wit di announcement of im death.

“Di president and commander-in-chief of di armed forces Al-Haji Umaru Musa Yar’Adua die a few hours ago for di presidential villa. Security aides don notify di National Security Advisor General Aliyu Gusau. Gusau don give di informate to di acting president. Di late president bin dey sick for some time. We go bring you official statement as soon as possible,” di announcement bin tok.

Di announcement no give official cause of death.

However, President Yar’Adua bin dey suffer from kidney disease. E spend months for one Saudi hospital wia im bin dey receive treatment.

For im absence, Nigerian lawmakers bin make di den vice president, Goodluck Jonathan di acting president.

Afta di death of Yar’Adua, dem swear in im vice, Goodluck Jonathan as president not long afta.

Patrick Ibrahim Yakowa (1948–2012)

Patrick Yakowa bin serve as govnor of Kaduna state from 2010 to 2012 wen e die inside one helicopter accident.

E die on 15 December at di age of 64 for di southern delta region, alongside five oda senior officials, im party tok.

Govrnor Patrick Ibrahim Yakowa and former national security adviser Gen Owoye Azazi bin dey for di helicopter wey crash for Bayelsa state.

Oda pipo for di accident na Dauda Tsoho and Mohammed Kamal, both aides, plus di two pilots: Muritala Mohammed Daba and Adeyemi Sowole.

Nigerian media tok say na Nigerian navy get di helicopter wey bin dey carry di officials go Port Harcourt.

Dem appoint oga Yakowa as deputy govrnor for July 2005, and e return as deputy govnor for April 2007 election.

Dem swear am in as govnor on 20 May 2010, as e take ova from former Govnor Namadi Sambo wey become vice president to den President Goodluck Jonathan earlier.

Afta di death of Yakowa, di state Chief Judge, Justice Rahila Cudjoe swear in im deputy, Mukhtar Yero di following day.

Mamman Bello Ali

Mamman Bello Ali bin represent Yobe South Senatorial District between 1999 and 2007 and e serve as di chairman senate committee on public account.

E contest and win di govnorship election for Yobe for 2007 under di defunct All Nigeria Peoples Party (ANPP) and bin dey office until im death for 2009.

E die of leukemia as e dey receive treatment for one hospital for abroad.

Isiaka Adeleke (1955–2017)

As at di the time of im death, Adeleke bin dey represent Osun West Senatorial District for di National Assembly.

E die for April 2017, at 62, for one hospital for Osogbo afta one political meeting wey last for hours.

Until im death, Oga Adeleke chair di Senate Committee on capital market.

E bin dey di Senate for di second time.

Oga Isiaka for 1991 also dey elected as govnor of Osun State.

Senator Bayo Osinowo (1955–2020)

Better known as Pepperito, Osinowo bin die of complications from COVID-19 on 15 June, 2020.

E be di lawmaker wey bin dey represent Lagos East Senatorial District and Chairman of di Senate Committee on Industries.

Osinowo, die at di age of 64, e bin also serve as Chairman of Lagos State House of Assembly Committee on Lands and Housing for 11 years.

Rose Oko (1957–2020)

Until her death for March 2020, Rose Oko bin serve as senator wey dey represent Cross River North Senatorial District.

She also be di Chairman of di Senate Committee on Trade and Investment.

Oko die for one facility for di United Kingdom weeks afta battling wit high blood pressure.

Source