Judge chop sack afta CJ discover say e sleep wit pesin from divorce case wey e handle

Di chief justice for Ghana, Gertrude Torkornoo don sack one circuit court judge for Jasikan over sexual exploitation of one client.

Alfred Kwabena Asiedu for hand over official properties, wit dockets and oda record books to di judicial secretary wit immediate effect.

Dis na some of di gist wey dey one letter di chief justice don write to di judge afta a disciplinary committee don investigate di mata.

Wetin happun?

One lady, Singari Diana Sadia don petition di chief justice in January 2023.

Di petitioner accuse di deposed judge, Alfred Asiedu of abuse of power, sexual exploitation and malicious prosecution.

At di time, di petitioner, Singari Diana get divorce case wey dey pend for di judge im court for Jasikan wey dey di Oti region of di kontri.

Inside letter wia di chief justice write to di judge, e don emerge say di judge “cause di arrest and prosecution of di petitioner without justification.”

Disciplinary committee investigate di judge

Afta Singari Diana Sadia don petition di chief justice, disciplinary committee of di judicial council probe di mata.

Di committee find say di judge Alfred Asiedu don “misconduct im serf wey im dey involve in improper relationship wit di petitioner.”

Na so di committee submit dia findings to di judicial council during dia 279th meeting on 25 October 2023.

Di council conclude say di actions of di Justice Alfred Asiedu don equal to “stated misbehavior.”

In accordance wit article 151 (1) of di kontri constitution, “all members wey dey di judicial council meeting agree say make dem sack di judge.”

Na so di chief justice don write to di judge wia im ask am to “handover all di official properties including im car.”

Di letter add say “di director of human resource for ensure say dem delete di deposed judge im name from di payroll wit immediate effect.”

Di court act 1993 (act 459) don state wetin pesin for get to qualify as judge.

Pesin wey dey appoint as circuit court judge for get high moral character and proven integrity.

Im also for get “proven integrity.”

Only last month chief justice Gertrude Torkornoo warn judicial service staff over misconduct.

Di CJ tok say im no go hesitate to sack any staff wey dey involve in bribery and oda forms of improper behavior.

Source