‘Na Army dey behind airstrike wey kill, injure pipo for Kaduna’

Di incident happun on Sunday as villagers dey celebrate Maulud according to reports

Getty Images

Di Kaduna state goment don comot to tok say na Nigerian Army carry out Sunday night air strike for Tudun Biri village wey kill and injure many pipo.

For statement, Samuel Aruwan wey be commissioner wey dey oversee ministry of internal affairs for Kaduna tok say Nigerian army don siddon wit deputy govnor Hadiza Balarabe to yarn say ‘na mistake’.

Di statement add say Major V.U Okoro wey be General Officer Commanding One Division tok say dem bin dey on a mission against some terrorists wen dem mistakenly bomb civilians.

Di Nigerian Air Force (NAF) bin earlier deny informate say dem get hand for one bombing wey kill many villagers for Tudun Biri village for Igabi Local Government Area of Kaduna State.

NAF Air Commodore Director of Public Relations and Information, Edward Gabkwet for one statement clear di air say dem no carry out any air operations within Kaduna state and environs in di last 24 hours.

E also note say NAF no be di only organization wey dey operate combat armed drones for di North western region of Nigeria.

Di statement add say e dey important make tori pipo confam tori before dem go press wit unverified and unconfirmed reports.

Videos wey dey circulate for social media dey show plenty deadi body wey spread for ground.

Tori be say dozens of pipo die for di raid. BBC News Pidgin neva verify di number of casulaties.

Some reports say di villagers of Tudun Birni bin dey observe dia annual Maulud program wey be to celebrate birthday of Prophet Muhammad (SAW) wen di incident happun.

Aruwan say search still dey go on for some of di victims but dem don move majority of dem to Barau Dikko Teaching hospital inside Kaduna city for treatment.

Di goment no comot to tok how many pipo die but deputy govnor Hadiza Balarabe say di goment dey condole with pipo wey lose dia loved ones for dis unfortunate incident.

Dis no be di first time wey dis kain tin go happun as for September 2021 anoda one happun.

For dat incident na Nigerian Air Force [NAF] admit say dia fighter jets kill civilians for Buwari village for Yobe state.

NAF say di fighter jet incident wey kill nine pipo and wunjure about 20 na mistake.

Air Commodore Edward Gabkwet, di tok tok pesin for Nigeria Airforce at di time say dem regret wetin happun.

Earlier Airforce bin comot to deny say na dia plane kill di civilians immediately after eyewitnesses tok to tori pipo about wetin happun.

Source