Oda kontris delegates list as Nigeria defend why 1,441 pipo attend COP28

Man stand in front of COP28 UAE Dubai 2023 banner

Getty Images

Nigeria dey share di number three position among kontris for world and di number one for Africa, wey carry di highest number of pipo go di 28th Conference of Parties (COP28) for Dubai, United Arab Emirate (UAE).

Di host of di conference UAE, get di highest number of delegates wit 4,409 badges. Brazil follow for second position wit 3,081 and both China and Nigeria, get 1,411 badges.

Nigeria get more dan 1,400 delegates for Dubai wey go dia for period wey di kontri dey face very serious economic palava and dey battle high cost of living.

Dis don cause plenty reactions from Nigeria pipo and opposition groups.

One of di presidential candidate for di 2023 elections, Peter Obi, post for im social media platform say e dey sad say Nigeria dey send di same number of delegates wit China.

Obi compare China 2024 budget, Human Development Index, levels of multi-dimensional poverty and population as im tok say Nigeria no get any business to dey send dat kain number of pipo.

Di former Anambara governor tok say: “majority of pipo for Nigeria delegation to COP28 na non-relevant civil servants or relations, friends and hangers-on of high goment officials. Most of dem no kuku understand or get anytin to di wit Climate Change.

Di opposition Peoples Democratic Party (PDP), also criticise di delegation saying na President Bola Ahmed Tinubu “friends, political followers and dia girlfriends” full di list “at huge expense to di kontri.”

President Bola Tinubu wit im delegates for di COP28

Getty Images

Wetin Nigeria goment tok about 1,411 delegates

Nigeria goment say no be di goment pay for all di delegates to go Dubai.

Senior special assistant to di president on media and publicity, Temitope Ajayi, say di delegates include climate activists, business leaders, environmentalists and journalists.

Ajayi add say odas wey follow go as delegates na pipo from goment agencies like Nigerian National Petroleum Cooperation (NNPC), Ministry of Niger Delta Affairs, Nigeria Maritime Administration and Safety Agency (NIMASA), Niger Delta Development Commission (NDDC).

But Ajayi no tok exactly how many of di delegates wey goment sponsor go di conference.

Delegates of oda African kontris wey go COP28

Kenya goment officially clear only 51 delegates go COP28 out of di 765 wey dey di United Nations Framework Convention on Climate Change (UNFCCC) list of participants.

Earlier di high number of 765 delegates bin make di kontri pipo para.

But di goment later clarify say aside from di 51 pipo wey goment give clearance, di rest na Kenya pipo from private sector, activists, county goment and parliament and no be goment dey sponsor dem.

Tanzania pipo too bin para about di 763 delegates wey dey represent di kontri.

Ghana delegation na 618 pipo, South Africa 410 and Zimbabwe 337 delegates.

Summit wit largest delegate in almost 30 years

Dis year COP conference for United Arab Emirates make history as di summit wey record di largest number of delegates.

More dan 97,000 participants get badges to attend di conference dis year in pesin.

Dis na almost two times di number of delegates wey bin travel go di Sharm El-Sheikh for Egypt for COP27 last year.

Di Egypt summit bin hold di position of conference wit di largest number of delegates in almost 30-year history of summits.

Dis year na also di first time wey 3,000 “virtual-only” participants bin dey list of delegates and dis make di total number of delegates for COP28 more dan 100,000.

Source