Izuchukwu Madubueze: How sexual harassment accuse make 23-year-old Nigerian man kill imsef

“Izu na very humble pesin, despite di fact say im papa na House of Rep member, im na very humble pesin, playful and intelligent and pipo bin dey wonder how pesin wey dey playful fit dey smart like dis?”

One of Izu Madubueze former secondary school mate for King’s High School, Satellite Town for Lagos, Nigeria tok as im remember am for di procession dem do to honour am.

Na sober mood for di Satellite Town residence of di Madubueze, wia family and friends gather on Saturday evening on 26, July, 2020 for candlelight procession for Izu.

Pipo wey attend di procession wear a touch of white with candles to say prayers and remember Izu.

“Wen we hear say im travel out, everybody bin dey happy and proud of am, and im be still dey tok to us, e no be proud pesin,” Di friend add.

23 years old Izu, shoot imsef dead afta im name appear for one list wey one twitter user for im former University for South Florida post online wey say im harrass one lady.

Im family beam im burial service via zoom for other family and friends to fit participate.

Im death shock pipo and make dem begin dey demand for justice.

Viral ‘sex offender’ list

One twitter user, Nanichi Anese publish im name and oda men name ontop social media inside one assault list wey no get goment approval.

For inside di list, di girl tag Izu under ‘Harassing’

Izu, say im try get across to Nanichi but she no gree give am details of wetin im do. All she tell Izu be say im offence na “non-physical sexual harassment” and di girl wey dey accuse am wan dey anonymous.

Inside some chats wey Nanichi post before she later hide her twitter, Izu show some chats wey im bin apologise and try to clear im name but even though Nanichi say she hear, she reply say she go stick with wetin di accuser tell her.

‘Promising young man’

Before im death, Izu na di creative director of im clothing line Uhuru.

According to im bio for Linkedin, im attend di Parsons school of Design.

Izu na also alumni of di University of South Florida and King’s High School, Satellite Town for Lagos, Nigeria.

According to one im former secondary school mates, im clothing line bin don dey pick up before im death.

Izu

BBC

Izu last words

Izu record im last words for video wey publish afta im death.

Im say dem no give am fair chance to clear im name or tok im side of di story or verify weda any of di allegation against am dey true. Im also reveal say for di last three years, im bin dey go through many tins.

“Na Thursday, 16 July 16, 2020 and I feel like e go dey awesome for me to say some last words before I leave”, im tok for di video suicide note.

“I don dey struggle wit my mental health for some time now and my close friends and some members of my family know say I try commit suicide last year and I fail. I bin dey well small small wit some self-therapy but honestly right now, dis whole situation don show why I no need to dey here.”

Justice for Izu

Inside press statement wey di Madubueze family release, dem tok say di death of dia son shock dem no be small and dem dey inside pain and sorrow.

Dem add say dem don forgive di pipo wey accuse dia son but dem no fit stop justice.

Nani twitter account dey locked as more and more details still dey drop.

And #justiceforIzu dey trend for di pipo wey get hand inside di mata to face justice.