Sunday Igboho don regain im freedom now for Benin Republic?

Yoruba Nation agitator, Oloye Sunday Adeyemo wey pipo sabi as Sunday Igboho, don get freedom to leave Benin after dem bin hold am prisoner afta about two years according to reports.

Tori about im release break on the 8 October 2023 afta im post a thanksgiving video for im Instagram, to say thank you to former President Olusegun Obasanjo and oda prominent personalities for Nigeria.

Lawyer wey dey represent Sunday Igboho in Nigeria, Yomi Aliyu SAN and one of Sunday Igboho aide, Ademola Omiyale confam dis tori to BBC Yoruba say true-true Sunday Igboho don dey released and e dey on im way to Germany.

For interview with BBC Yoruba, im lawyer, Yomi Aliyu SAN explain say nothing dey stop Sunday Igboho from entering Nigeria now wey di goment don release am, as dem no get any case with am.

“If Benin say im dey free to go and say e no offend dem, im fit enter Nigeria now. Im fit come into di kontri if im want.”

Dem arrest Sunday Igboho for Benin for 2021 afta DSS attack im house on allegation of im separatists activities.

Wia Sunday Igboho dey now?

Onolalapo Omiyale and Yomi Aliyu confam to BBC Yoruba say Sunday Igboho, as at Sunday bin dey di capital of Benin Republic but e dey set to travel to Germany overnight.

Igboho bin dey on im way to Germany wen authorities stop am for airport for Benin before dem detain am.

Omiyale also explain say, “for a while now, im bin dey detained in Benin but di goment of Benin don come out to say dem no get any problem with am and so im dey free to leave di kontri.”

E don reach two years since Sunday Igboho dey arrested by law enforcement for Benin when e try to escape from Nigeria to Germany with im wife.

Igboho bin dey try to runaway from Nigeria becos DSS declare am wanted in Nigeria after dem storm im house for Ibadan, Oyo State Nigeria.

Dis attack happun after di Nigerian goment accuse Igboho say e call for di secession of Nigeria by leading di call for a Yoruba Nation.

Di attack on im house na becos e also bin dey accused say e hide weapons for im house.

Di Yoruba activist, Sunday Igboho bin dey go across di South-West geopolitical zone to campaign make di south west states separate from Nigeria to stand alone.

E say dis don become necessary sake of di injustice di pipo of di region and di insecurity wey dey grow worse for di kontri.

Source