Wetin you need know about Skill Up Nigeria wey go replace N-Power

Di Nigeria goment don introduce one new Social Empowerment Programme wey dem call Skill-Up Nigeria.

Dis new programme na di expanded version of N-power wey di goment suspend temporarily sake of magomago.

Di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation wey announce dis new development tok say di new N-power 3.0 na to serve Nigerians better.

For one statement wey di ministry tok-tok pesin, Akindele Egbuwalo release, e tok say dis Skill Up Nigeria na di transformed and restructured version of N-power and e dey target five million beneficiaries in 5 years.

Why goment temporarily suspend N-power

N-power na one National Social Investment Programme of di previous administration for Nigeria.

Na former president, Muhammau Buhari launch di scheme for 2016 to address di issue of youth unemployment, reduce poverty and to help social development.

Di N-power scheme dey created for unemployed graduates and non-graduates wey dey di ages of 18 and 35. Di programme na for only two year, during dis time, goment go attach di beneficiaries to any goment job for di state dem dey stay and dem dey pay dem 30,000 thousand naira every month.

Di minister of humanitarian affairs, Betta Edu tok say di total number of pipo wey don benefit from N-power since e start na 960,000.

She say most of di beneficiaries wey enta from Npower 1.0 and Npower 2.0 batch A and B don comot di programme.

Di Ministry of Humanitarians Affairs wey dey oversee di programme tok say dem discover plenty magomago for di programme.

However, madam Edu tok say dem gatz temporarily suspend N-power programme across di kontri so as to torchlight di operations of di programme in di last twelve months.

“Recently, we discover say some beneficiaries dey wey dia contract don end since 2022 but dem still dey and dey expect payment from goment. Some beneficiaries no dey report to dia place of primary assignment but dem still receive monthly payment. Some get oda jobs and don comot from dis brackets but dem still dey benefit from di payment, while those wey truly dey do di work no dey collect money.

“Findings show say consultants dey hold on to beneficiaries money and dem no dey pay dem even though dia contract don end since March 2023 without any renewal.” Di statement tok.

Di ministry tok say dem wan investigate di programme and assure all beneficiaries wey get genuine complain say, dem go resolve all dia cases afta dem complete di verification exercise.

Wetin to know about Skill Up Nigeria

Although much informate neva dey about Skill Up Nigeria wey be N-power 3.0.

Di ministry reveal say dis new N-power level still dey load.

However, di ministry tok say e go accommodate new programmes in education, health, works, agriculture, technology, fashion, entertainment plus oda relevant areas of skill acquisition and employability.

Di restructured programme go also reach beneficiaries wey dey di age of 18 and 40 (di previous age limit na 35).

Also, di target na 5 million beneficiaries in 5 years at di pace of 1 million per year under di graduate and non-graduate stream.

Source