Sudan crisis: ‘Di issue between NEMA and di transport company don settle’ – Nigeria goment react to trending video

Why we dey spend $1.2 million for 40 buses to evacuate Nigerians from Sudan

Reuters

Nigeria goment don react to one viral video wey show as some pipo dem evacuate from Sudan, wia war dey go on, dey lament say di buses wey carry dem don abandon dem for di middle of di desert.

Di Chairman, Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM), Abike Dabiri for her Twitter account give assurance say she don follow di National Emergency Management Agency (NEMA) Director tok and e confam say di buses don continue dia journey and dem don resolve whatever issues dem bin get.

She add say di issue between NEMA and di transport company don dey settled and di buses don continue di journey.

Di reaction dey come afta one viral video wey show as students wey dey come from Sudan allege say “di buses wey dey evacuate Nigerian students and non-students stop for di middle of di Sahara and di drivers refuse to continue di journey because dem neva collect money.”

“We dey stucked for dis desert for five hours, we no sabi wia we dey, we no get money, we no get food, we dey for unknown environment inside very big danger. Di bus driver say dem no dey move dia bus as dem collect money.” Di evacuees allege for di viral video.

Plenty reactions don follow dis video as some pipo say why goment no go pay di bus drivers afta dem don earmark $1.2m to hire luxury buses to evacuate Nigerians from Sudan.

Di Minister of Foreign Affairs Geoffrey Onyeama tok say Nigeria go spend $1.2 million to hire luxury buses wey dey transport di evacuees to Egyptian border.

Onyeama wey appear for Arise TV tok say di $1.2 million na to transport 5,500 Nigerians wey dey stranded for Sudan. Wen dem land for Egypt, Nigeria goment go airlift dem back to di kontri.

Di minister say e take Nigeria $1.2m for di buses to convey di stranded citizens to Egypt sake of di risk wey dey involved.

E say di providers increase di price of di buses sake of di risk wey dey involved in di road trip.

Onyeama say pipo bin attack French convoy and e dey difficult to procure di buses.

“Tins get more dangerous afta dem attack di French convoy, obviously, pipo go begin charge you more sake of say di risk dey greater,” Onyeama tok

E add say Nigeria fit no spend reach di $1.2m if di number of pipo wey di buses move enta Egypt no reach 5,500 at di end of everytin.

First set of evacuees dey expected to land on Friday

However, di NIDCOM chairman don announce say di first batch of stranded Nigerians for Sudan wey di Nigeria goment dey evacuate go land Abuja, Nigeria on Friday , if no any unforeseen circumstances show face.

Erewa-Dabiri give di informate for one State House press briefing for Abuja on Thursday.

She say a total of 13 out of di 40 buses dem rent to transport Nigerians from di troubled Sudan don already comot since Wednesday and e go by road to Boarder town of Aswan for Egypt where di Embassy staff for Egypt plus di DG of NEMA go receive di evacuees.

She say 10 of those buses transport Nigerians from Universities for Khartoum while dem send di remaining three buses to El- Razi University to carry dem go di boarder town for Egypt.

On accuse of segregation and discrimination for di evacuation process, Madam Abike clear am say dem bin give children and women priority.

How di evacuees go take land Nigeria

Di NIDCOM boss say one boeing 777 from Airpeace go comot Lagos by Thursday evening and go bring di first batch home on Friday.

She assure all Nigerians say dem go bring back all those wey register dia names to comot Sudan irrespective of status , gender and state.

No Nigerian don die for Sudan

Di Minister of State for Foreign Affairs Zubairu Dada tok say no Nigerian don die for Sudan since di crisis start on 15 April.

“Di evacuation dey in batches to ensure di safety of all Nigerians. But di good news be say no Nigerian life don dey lost so far,” Dada tok

E say all Nigerians dey safe and goment dey confident and hopeful say nobody go die.

Some Nigerians don enta Saudi Arabia

Dada also tok say some Nigerians don already dey evacuated through ship by di goment of Saudi Arabia.

“Let me also add say some Nigerians don dey evacuated by ship, I guess from Port Sudan, by di goment of Saudi Arabia,” e tok.

According to Saudi officials, ova 1,000 pipo arrive for Saudi Arabia by ship from Sudan on Wednesday, and majority of dem na foreigners.

Dada tok say dis na joint effort as Nigeria get friendly nations wey dey ready to assist.

Why Nigerians plenty for Sudan

Di Minister of Foreign Affairs Geoffrey Onyeama tok say Nigeria get excellent relationship wit Sudan.

E say Sudan get highest number of Nigerians for diaspora statistically.

“Wetin pipo no realise be say, I tink statistically Sudan get di highest number of Nigerians for diaspora for di world. Most pipo go tink say na di US, di UK and dose kinds of tins. But Sudan use to be di route Nigeria bin dey take go perform Hajj for Mecca ova centuries and lots of dem go just settle for Sudan, and so huge number dey,” Onyeama tok.

E say oda factors wey attract Nigerians to Sudan na sake of say di kontri get beta reputation for education and Islamic studies.

Who dey fight who for Sudan?

Di Sudan army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) don dey fight since Saturday for clashes wey don kill ova 400 pipo.

Since di 2021 coup for Sudan, na council of generals wey two military men dey lead dey run Sudan.

Dis two military men na dem dey di centre of di crisis inside di kontri.

Gen Abdel Fattah al-Burhan, wey be di head of di armed forces and in effect di kontri president.

And im deputy and leader of di Rapid Support Forces (RSF) Gen Mohamed Hamdan Dagalo, wey dey known as Hemedti.

Two of dem disagree with each oda on di direction wey di kontri dey go and di plan move to bring civilian rule.

Di main issue na plans to include di 100,000-strong RSF into di army, and who go then lead di new force.

Wetin di two sides want?

Gen Dagalo don bin tok say di 2021 coup na mistake and don try to present imsef and di RSF to show say dem dey di pipo side, against di Khartoum elites.

While e get some support, odas find dis message hard to believe sake of di paramilitary force wicked track record.

Meanwhile, Gen Burhan don bin tok say di army go only fully hand ova power to elected goment.

But suspicion dey ground say both military men, and dia supporters, dey worried about wetin fit happun to dia wealth and influence if dey remove dem from dia powerful positions.