Fotos of how thousands of inmates move to El Salvador mega-prison

EL Salvador

Reuters

Authorities don move di first group of 2,000 suspected gang members for El Salvador to one big new prison.

Na di centrepiece of President Nayib Bukele self-declared war on crime.

Dem catch tens of thousands of suspected gangsters for di kontri under a state of emergency sake of increase in murders and oda violent crime.

Prisoners

Reuters
Prisoners

Reuters

Di prison go eventually hold more dan 40,000 pipo.

Pictures show how di first big group of inmates – wit tattoo without shoe – dey enta di facility wit chains.

prisoners

Reuters

Di prisoners bin siddon for floor wit dia hands behind heads wey dem shave, close togeda, before as dem take dem to dia cells.

prisoners

Reuters

President Bukele tweet say dem transfer di first 2,000 pipo “at dawn, for one single operation” go di Center for di Confinement of Terrorism, wey im say na di largest jail for Americas.

“Dis go be di new house, wia dem go live for decades, all mixed, wia dem no harm di population.”

prisoners

Reuters
prisoners

Reuters

Di mega-prison – for Tecoluca, 74 kilometers (46 miles) southeast of di capital San Salvador – e get eight buildings.

Each get 32 cells of about 100 square meters (1,075 square feet) to hold “more than 100” prisoners, di goment tok.

Di cells only get two sinks and two toilets each.

Prisoners

Reuters

Di mega-prison – for Tecoluca, 74 kilometers (46 miles) southeast of di capital San Salvador – e get eight buildings.

Each get 32 cells of about 100 square meters (1,075 square feet) to hold “more than 100” prisoners, di goment tok.

Di cells only get two sinks and two toilets each.

Prisoners

Reuters
prisoners

Reuters

President Bukele bin declare “war on gangs” last March, pass emergency measures wey im don extend several times.

Di emergency powers dey controversial as dem limit some constitutional rights, like allowing di security forces to arrest suspects without warrant.

prisoners

Reuters
prisoners

Reuters

More dan 64,000 suspects been chop arrest for anti-crime drive.

Authorities say criminal gangs like MS-13 and Barrio-18 reach tens of thousands and dem dey responsible for homicides, extortion and drug-trafficking. Di plan of di mass arrests na to make di gangs “disappear altogether”, goment tok.

Human rights organisations say innocent pipo been dey caught up for di policy, and some of di pipo dem catch being dey subjected to “cruel, inhuman, or degrading treatment”.

But Bukele anti-gang push still deys popular wit Salvadorans.