Authorities find Second batch of classified Biden documents

Joe Biden dey tok to Journalist

Getty Images

US President Joe Biden aides don find fresh batch of classified goment records for di second location, for one growing political embarrassment for di White House.

Dem bin find di first cache for di private office for Washington DC say Oga Biden use afta im vice-presidency.

Di US Department of Justice dey chook eye for di mata.

Former President Donald Trump dey face criminal investigation say e allegedly mishandle classified files.

E neva clear yet on Wednesday wen or wia Biden aides find di additional tranche of files.

Dem discover di original batch of about 10 documents for November for di Penn Biden Center, one think tank near di White House, but e only just come to light dis week.

Doz papers reportedly include US intelligence memos and briefing materials wey relate to Ukraine, Iran and di United Kingdom.

Di White House neva comment on di new batch wey dem find. However, di BBC US partner CBS and oda US media don confam.

During her daily press briefing for Wednesday, Biden press secretary Karine Jean-Pierre no gree ansa questions about di first cache of files.

“Dis one dey under review by di Department of Justice,” she tok. “I no go go beyond wetin di president share yesterday.”

Oga Biden bin tok on Tuesday say e dey “surprised” by di discovery of di records and dey “co-operate” wit di justice department review.

Di controversy dey come as di Democratic president face inspection from one new Republican majority for di US House of Representatives.

“Now wey Democrats no longer get one-party rule for Washington, oversight and accountability dey come,” James Comer, di new chairman of di House Oversight Committee, tok for Wednesday.

Di committee dey launch inquiries into di president and im family, including one request for di White House to turn over documents and communications wey relate to di classified files.

Di law require say all White House records, including classified ones, make dem turn over to di US National Archives afta one administration time for office.

Donald Trump supporters upset with FBI search
The British Broadcasting Corporation

Di White House don tok say Oga Biden lawyers alert di archives as soon as dem recover di classified materials for di think tank, and di agency recover dem di next morning.

Last August, FBI agents bin search di Florida home of Oga Biden predecessor and seize more dan 10,000 files wey Oga Trump never turn over to di National Archives.

Di justice department bin sama subpoena for di return of di sensitive files before di FBI show up for Mar-a-Lago.

More dan 300 documents wit classified markings, including 18 wey dem mark as top secret, dey recovered by federal agents from di golf club for Palm Beach.