Goodluck Jonathan APC 2023: former president reject All Progressives Party presidential form group buy for am

Nigeria former president Goodluck Jonathan don reject and rubbish di presidential nomination form wey one group bin buy for am.

Inside statement wey im Media Adviser Ikechukwu Eze sign, e say, e no dey aware and e no sign am.

“E don come to our notice say one group buy Presidential Nomination and Expression of Interest forms, of di All Progressives Congress APC, in di name of former President Dr. Goodluck Ebele Jonathan.

We wish to categorically say Dr. Jonathan no dey aware of dis bid and e no authorize am. We wan state say if di former President wan to contest an election, e go make im intentions clear to di public and no go enta through di back door.” Di statement tok.

Di statement also tok say Jonathan never decide weda e go contest or not.

“While we appreciate di ogbonge request by some Nigerians, for Dr. Jonathan to make imself available for di 2023 Presidential election, we wish to state say e never in anyway, commit imself to dis request. To buy a presidential aspiration form in di name Dr. Jonathan without im consent, knowing di position wey e don hold for di kontri dey considered as an insult to im pesin. Di general public dey herefore advised to disregard am.” Di statement add.

Wike on 2023 presidential race: ‘I no go step down for any consensus candidate’
The British Broadcasting Corporation

Jonathan dump PDP and port to APC?

Although di statement from Jonathan clearly rubbish di tori say dem buy am APC form to contest di upcoming elections for di kontri, e no tok clearly abvout if e join APC or not.

Di tori say e port start to spread more on Monday night afta one of President Muhammadu Buhari aide Bashir Ahmad Tweet say Jonathan don port.

E never clear which group buy di form yet but di APC presidential nomination and expression of interest forms na N100 million naira. Sometin wey also dey cause tok-tok for di kontri.

No be today though dis tori say Jonathan go port or say e don port start.

For months now, speculations dey say di former Nigerian president dey plan to defect from di main opposition party, PDP to di governing APC party and den to join di race for di presidency.

Inside all dis, Jonathan never ever yet come out publicly to confam or deny say anytin like dat go ever happun or not.

Rochas Okorocha on Igbo presidency for Nigeria 2023 election
The British Broadcasting Corporation

Jonathan get interest to contest for 2023 presidential race?

Anoda question wey pipo dey ask na weda Jonathan get interest to contest for di 2023 elections.

Jonathan never confam dis wan too.

Wetin im latest statement tok about am na say: “While we appreciate di ogbonge request by some Nigerians, for Dr. Jonathan to make imself available for di 2023 Presidential election, we wish to state say e never in anyway, commit imself to dis request.”

For April 2022, one group bin storm Jonathan Abuja office to demand say make e declare for di 2023 presidential election. Dem carry placard dey call im name wia dem ask am make e please contest.

But Jonathan response to dem den na say make dem “watch out”.

“Yes, you dey call on me to come and declare for di next election. I no fit tell you say I dey declare. Di political process dey ongoing; just watch out. Di key role you must play na say Nigeria must get somebody wey go carry young people along.” E bin tok.

Goodluck Jonathan

Getty Images

Jonathan fit contest for 2023 election?

Yes e fit.

Di former president serve from 2010 to 2015 as president of Nigeria. According to di constitution. E still fit serve one more term of four years if e decide to run again.

Who be di candidates wey don declare to run for president under APC?

As at di time of filing dis report, more dan 15 pipo don come out to declare say dem wan contest di seat of di president under di APC.

Dem include di current Vice President Yemi Osinbajo and former govnor of Lagos state Bola Tinubu.

Di 2023 presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023 according to di election office INEC.

While govnorship and state assembly elections go hold for March 11, 2023.

INEC don give all political parties for di kontri deadline of June 2022 to do dia primaries and produce dia candidates wey go fly di party flag for di general election.

APC nomination form price list

House of Assembly – N2 million

House of Reps – N10 Million

Senate – N20 million

Governorship – N50 million

Presidential – N100 million

“Forms for female aspirants and pipo wey dey live wit disability na free.” APC add.

“Youth wey dey age 25 – 40 years get 50% discount to buy di nomination forms,” Argungu tok.