Italy vs England: Italy win Euro 2020 on penalties

Italy na di new champions of Europe afta dem beat England 3-2 on penalties.

Italy goalkeeper Gianluigi Donnarumma save crucial penalty from Bukayo Saka to send di Italians into jubilation.

Despite two saves by Jordan Pickford, missed penalties from Marcus Rashford, Jadon Sancho and Saka prove decisive.

Afta 120mins, nothing fit separate England and Italy as di final of Euro 2020 enter enter extra time.

Dis na di second Euros final wey go dey decided on penalties as di match end 1-1 during regulation time.

England bin take di lead as early as di second minute through Luke Shaw.

Di Manchester United left back ghost in behind di Italy defence and hit half-volley from Kieran Trippier cross.

England look like dem go go on from dia to consolidate on dia early lead but di Italians wey enjoy much of di possession son equalise.

Di goal no look pretty but Italy no go care as Leonardo Bonucci tap in from close range to level di scores for di 67th minute.

Donnarumma di giant

Lots of credit go go to Italy goalkeeper Donnarumma as im prove big between di sticks for di Azurri’s.

Im save two of England penalties – from Saka and Sancho, no wonder Uefa vote di former AC Milan goalkeeper as player of di tournament.

No be only for di final Donnarumma shine, im bin no concede any goal during di group stage of Euro 2020 until di round of 16.

More pain for England

Bukaya Saka and Harry Kane

Getty Images

For over an hour e bin look like football dey ‘come home’ as England bin dey lead.

Dis na anoda heartbreak for England wey last win major trophy at dis level for 1966.

Pickford perform heroics to save Andrea Belotti and Jorginho penalties but just like Saka, e also begin cry as im effort bin no dey enough.

After so much hope, England long wait for trophy go continue.