Burna Boy Twice As Tall download, track list and how to listen to di new album of di award winning Nigerian singer wey make pipo dey hala

Burna BOy

Getty Images

Fans dey react to Nigerian award winning singer Burna Boy latest album Twice as tall wey drop early on Friday morning Nigeria time.

Di song wey be di ‘African Giant’ singer fifth album, na Sean ‘Diddy’ Combs, US ogbonge rapper Sean Diddy Combs and Bosede Ogulu, Burna Boy mama be executive producer.

For di 15-track project, di ‘Ye’ singer feature oda ogbonge singers like Stormzy, Coldplay’s Chris Martin, Youssou N’Dour, Naughty By Nature, and Sauti Sol.

Where you fit listen?

Di official place to listen and download di album na for spotify, apple music, Boomplay, ITunes store, deezer, YouTube, Google Play and napster according to wetin di ‘African Giant’ tweet.

See di tracklist:

‘Level Up (Twice As Tall)’ [feat. Youssou N’Dour]

‘Alarm Clock’

‘Way Too Big’

‘Bebo’

‘Wonderful’

‘Onyeka’ (Baby)

‘Naughty By Nature’ [feat. Naughty By Nature]

‘Comma’

‘No Fit Vex’

’23’

‘Time Flies’ [feat. Sauti Sol]

‘Monsters You Made’ [feat. Chris Martin]

‘Wetin Dey Sup’

‘Real Lif[fee’ at. Stormzy]

‘Bank On It’

Wetin be reactions to di song?

Award winning Nigerian singer Innocent Idibia aka 2Face say “dis one pass Grammy”.

While Sean Diddy Combs call am “di album of di year”.

See tweets of some of di reactions.