Nigerian schools resumption and Waec examination date: Federal goment say Secondary schools fit reopen on 4 August

Nigerian schools resumption and Waec examination date

Getty Images
Nigeria schools reopening and Waec examination timetable latest update

Nigeria goment don tok say Secondary schools for di kontri fit reopen as from di 4th of August, 2020.

But dis na for those wey dey for examination classes.

Students go get two weeks within which to prepare for di West African Examinations (WAEC) due to start on di 17th of August, 2020.

Na di Federal Ministry of Education, Honourable Commissioners of Education of di 36 states, di Nigerian Union of Teachers, (NUT), di proprietors of private schools, and Chief Executives of examination bodies dem agree on dis decisions today, 27 July afta dem do virtual meeting.

Dem agree say make examination classes resume immediately after di Sallah break wey go shelle on Friday, so make dem for prepare for di WAEC examinations wey go start from 17 August.

Di joinbodi dem com appeal to di Federal Goment say make dem assist schools for di kontri say make di schools reopening fit dey fast and safe.

Di Federal Ministry of Education go still do anoda meeting tomorrow 28 July but dis time dem go meet di joinbodi of Chief Executives of examination bodies like NECO, NABTEB and NBAIS.

Dem wan make dem harmonise dia examination dates wey di goment go come announce to stakeholders.