Big Brother Naija Season 5 housemates biography: Lucy and Praise na new Head of House afta Nengi reign for BBCNaija lockdown

BBCNaija Housemates latest tori na say Lucy na new Head of House afta Nengi reign for lockdown season 5.

Lucy select Prince as di Deputy Head of House. Lucy dey take over from Nengi di first head of of house for di 2020 lockdown season.

Lucy Essien

Lucy Essien na 30-year-old entrepreneur from Cross River. She say she be simple girl not so average and can dey mean and rude if pesin step on her toes.

Lucy say she believe in fairy tales, like good food and like her space.

Nelson Enwerem Prince

Nelson Enwerem Prince wey be 24 years old na entrepreneur from Abia. E don do modelling, fashion designing plus interior decoration and na graduate of pure physics from the University of Calabar.

Prince say im like to dey ignore pipo knowingly and like working out, swimming, food and reading about ancient religions and African history.

HOH Benefits

Organisers of Big Brother Naija 2020 bin don earlier announce inside one statement say dis year edition go witness upgrade in terms of benefits wey di Head of House (HOH) go fit enjoy compared to winners from previous ones.

“Dis year, di HoH privileges go see some major upgrades. For dis new season, di Head of House go get to enjoy a lounge all to themselves! Di HoH lounge go get living room area, bedroom, fitted bathroom, and a private bathroom,” Di organizers tok for statement.

“Additionally, di HOH go dey allowed to select a deputy to assist dem to cari out dia duties and dem fit get to add some BBNaira to dia Betway Wallet….”