Toke Makinwa Banana Island house, Amcon sieze am?

“We Move” na di two words wey Toke Makinwa tweet on Monday as tori begin fly upandan say di popular radio personality for Nigeria lose her Banana Island house to Amcon.

Tori be say Toke Makinwa tell one Twitter user say she go heal all di pipo wey dey laugh am sake of di news say the Asset Management Company of Nigeria (AMCON) lock im house.

Makinwa wey don dey trend since di news break add say “we move”.

Asset Management Corporation of Nigeria (AMCON) na di Nigerian office wey dem establish by Act of di National Assembly of Nigeria for July 2010 wit a plan say e go stay for 10 years lifespan.

Although BBC Pidgin no go fit verify, some fans and Twitter users react ontop di mata dey claim say Toke Makinwa house na Festus Fadeyi, Di Chairman, Pan Ocean Oil Corporation, wey get 240 billion naira gbese to settle wit Amcon.

AMCON work na o settle non-performing loan assets. Local Tori pipo tok say AMCON lock di house sake of debt wey dey ontop di house.

See as Nigerians dey reach

Toke Makinwa however pas some coded message for retweets

Toke Makinwa: “Money no dey for dis job o, but you go get exposure”
The British Broadcasting Corporation