‘I no dey sure say I fit go Hajj next year’ – Auwal lament ten million naira bill to go Mecca

Pilgrim performing Hajj

Getty Images
Mecca

Di National Hajj Commission for Nigeria (NAHCON) announce say di federal goment no fit provide subsidy for di 2025 Hajj, meaning be say pilgrims for Nigeria go pay by dem sef.

Most of di goment subsidy for pilgrims be say na di way dem dey give dem dollars wey dey allow dem access am at low rate from di Central Bank of Nigeria (CBN).

Dis mean say di way di current exchange rate dey over 1,600 naira ($1), pilgrims wey need to pay at least $6,000 each, go pay up to 10 million naira ($7,500) for di 2025 exercise

But many Nigerians no happy wit di goment decision for not giving subsidy sake of e go dey veri difficult for dem to participate for Hajj next year.

Abdullahi Muhammad Auwal tell BBC News Pidgin say e dey veri disappointed and e no happy wit di way Hajj dey cost everi year for Nigeria sake of bad economy.

“Last year pipo come pay N8-9 million as Hajj fare and now dey come dey tok say e go reach or pass 10 million naira per pesin. I no happy at all and I dey disappoint, for now I no dey sure weda I fit go next year Hajj.”

“But anytin we fit do, becos our money no get value if to say our money get value e no go pass two to three million.”

E tok say now pipo no fit dey save moni again for Hajj sake of how e dey expensive now and di way evritin for di kontri dey become hard.

“Di only good tin be say Hajj no dey compulsory in Islam na for dos wey get di money, so na just time if you dey destined to go you get di chance go Saudia, but for me I no dey sure if I go fit go.”

E call on di goment na not just for dem to pay Hajj subsidy but na to bring down di dollar price wey dey high against di Naira becos na im be di main reason why di Hajj fare dey go up like dis.

Hajj fare in recent years

Dia is significant increase in Hajj fare wey don reach around 100% compared to di way e dey for di past years wia e no even reach one million naira per pesin.

For 2015 di fare dey 758,476 ($469) while for 2019 di Muslim Pilgrims Welfare Board approve 1. 5 million naira ($980) as Hajj fares for dat year for di intending pilgrims in the territory.

However, in 2024 Hajj di Hajj commission tok say dat year fresh payment for Hajj go reach of 8 million naira depending your location in di kontri.

At di time na im be reason why current administration of Bola Ahmed Tinubu decide to give 90 billion ($55,000) as subsidy for pilgrims.

Di decision create many reaction in di kontri wia some pipo describe di Federal goment move as misplacement of priority.

Source