Nigerian schools resumption latest from ASUU and Waec examination update

Nigerian schools resumption upda today be say di head of universities lecturers union want goment to keep schools closed until next year.

Tori be say di President, Academic Staff Union of Universities (ASUU) don ask di Nigerian goment make dem shut down schools till 2021 to prevent di spread of coronavirus.

Dis dey come on top di Nigerian goment decision not to let Unity Schools write di West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) wey suppose start for August 4.

Asuu say e stand for goment back gidigba on top di decision to postpone di exam as di Minister of State for Education, Chukwuemeka Nwajiuba, yarn say di ministry don meet wit WAEC pipo dem on Monday and dem don agree to consult wit four oda kontries to come up wit a new date for di exam.

However, for interview with local tori pipo, Punch, dia Asuu presido, Prof. Biodun Ogunyemi tok say make Nigeria look Kenya, wey close down all dia schools till 2021, on top say na safety dey important pass even if need dey for schools to lock up till 2021.

E tok say e no wan use pikin life take play na why di addvise dey come make schools shut down for now.

For statement wey Asuu release yesterday, dem tok say di way wey goment schools dey now wit overcrowded classrooms dem and no running water go make am almost impossible for students and pikin to practice social distancing and personal hygiene.

But social media don dey run comments on weda dis tok from Asuu na really to benefit teachers or dia lecturers.

Goment bin postpone di WAEC examination for Senior Secondary School students wey suppose start 4 August on top di coronavirus kata-kata and bin even plan to reopen schools for SS 3 students to fit do revision for dia exams but go back on dia decision on top say e no dey safe.

But na all da one go still need rethinking.