Nnamdi Kanu: Appeal court rule say di IPOB leader gatz remain for DSS custody

Court of Appeal for Abuja, on Friday uphold di Federal Goment of Nigeria application for stay of execution of di 13 October judgment wey bin free Nnamdi Kanu.

Nigeria goment bin carry case between am and di leader of di proscribed Indigenous Pipo of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu, go Supreme Court to appeal against di execution of di October 13 Court of Appeal judgement wey discharge am.

Inside statement wey Nnamdi Kanu lawyer, Ifeanyi Ejiofor, release, e say court grant di appeal to stay execution on Friday 28 October, but na entirely new panel of justice dem grant di stay.

Di presiding judge, Justice Haruna Tsanammi also order make di two parties settle dia records and make dem forward di result of di ruling to di Supreme Court within seven day for to make sure say dem do di hearing of di appeal sharply.

Dis ruling mean Oga Kanu, gats remain for di custody of di Department of State Services pending when di Supreme Court go hear di case.

‘We go appeal di ruling’ – Ejiofor

But Oga Ejiofor say dem go appeal di ruling of di court to stay di execution.

“We go challenge today Ruling of di Court of Appeal we stay di execution of im judgement afta consulting wit di lead Lawyer – Chief Mike Ozekhome.”

Ejiofor say say dem no inform dem on time about di Ruling on time, as dem only hear about am “barely 45 minutes before di time of di Ruling.”

E go on to encourage all Kanu supporters “to remain calm” as di decision of di appeal court today no affect di judgement wey discharge Kanu.

Who be Nnamdi Kanu?

"Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] 'Nnamdi Kanu extradition arrest' in Nigeria ', go appear for Nigeria court - 'Abubakar Malami'

Getty Images
Nnamdi Kanu na im dey operate Radio Biafra

Nnamdi Kanu na Nigerian separatist leader and founder of di Indigenous People of Biafra (Ipob), one group wey want a breakaway state for south-east Nigeria. E found IPOB for 2014.

Kanu grow up for south-east and attend di University of Nsukka.

E move to di UK before graduating.

Soon afta e set up Ipob, e speak to gatherings of di large Igbo diaspora, calling for Biafran independence.

For some some of im comments, e ask Biafrans to take up arms against di Nigerian state.

“We need guns and we need bullets,” e bin tok for one of such address.

And dat na wetin bring am to di attention of Nigeria security services.

Kanu dey seen by many as a dangerous propagandist, but e dey also consider as a lightning-rod for di way many Igbos still feel unhappy about Nigeria, years afta a three-year civil war between 1967 and 1970.

Authorities arrest Nnamdi Kanu for 2015 wen e return to Nigeria but dis only boost im profile.

Di man wey many Nigerians bin dismiss as troublemaker, even within im ethnic group, become di most talked about Igbo pesin.

Kanu form di Biafran Security Services (BSS), one mock militia wey dey dress in black and do parades for di eastern city of Abia, im home state.

As di Nigeria goment see say im group dey overdo too much, court come declare Ipob as terrorists group and ban dia activities.

For September 2017 di Nigerian army carry out one raid for Kanu house but e escape.

Many bin tink say dat na di end, but Kanu reappear for Europe for 2018 and continue di radio broadcasts wey e bin don dey do before

For late 2020, e resurrect di BSS and rechristen am di Eastern Security Network (ESN).