‘I need justice for my pikin wey soldier allegedly kill for Kaduna’ – Victim papa share wetin happun

Deseaced Foto

Nazifi Muhammad
Isma’il wey soldier bin kill for Zaria, Kaduna

Di papa of one 16-year-old boy, Isma’il Muhammad, tok say im want justice for im pikin wey dem say soldier allegedly kill for Samaru area for Zaria, Kaduna State.

Dem tok say di alleged shooting happun for morning for di boy house as soldiers dey patrol, afta di Kaduna State goment bin announce curfew becos of di protests wey turn violent.

Di late Isma’il Muhammad, wey be 16-year-old boy, dey live for Samaru area for Zaria Local Goment Area of Kaduna State.

E just finish junior WAEC exams and e bin wan kontinu im education for higher institution.

Bifor e die, e dey learn tailoring wit im broda Nazifi Muhammad to support imsef.

For di day wey di incident happen, Isma’il and about five odas dey sit down for front of dia shop, near dia house, wen soldiers arrive.

Isma’il papa, Muhammad Husaini, tok say e no dey house wen di incident happun but dem call am tell am, wey make am rush comeback.

Husaini tok say, “Wen e happun, di children dey for front of dia shop wey no even near di road wen soldiers come patrol di neighbourhood behind Samaru market. Di children run inside afta dem see di soldiers.

“One of di soldiers point im gun at dem and tok say e go shoot. Di children run inside and lock di door.”

E say even though dem enta house lock di door, di soldier shoot di door twice, and “na im kill Isma’il”.

Husaini add say, “Di bullet hit am for im neck and back, and wen di soldier hear am scream, e waka comot.”

Di papa tok say e want make dem do justice for im son wey di soldier bin kill.

One eyewitness, Nazifi Muhammad, wey be Isma’il broda, tok say dem dey togeda wen di incident happun.

“We enta house and lock di gate, but di soldier follow us reach our house and shoot twice. One bullet hit am for back, and di oda one hit am for neck.”

“We carry am go outside to show di soldiers wetin happun. At first, dem deny am, but later dem accept say na one of dem do am,” Nazifi talk.

Di Commanding Officer of di Nigerian Army 1st Division, Major General MLD Saraso, visit di boy family to sympathise wit dem.

Di Nigerian Army don announce say dem don arrest di soldier wey dem accuse of killing di young boy during dia patrol for Samaru area for Zaria, Kaduna State.

Source