‘Dis period fit dey hard on us’ – Key tins Tinubu tok for im new address to Nigerians

Nigeria President Bola Ahmed Tinubu don urge Nigerians to look beyond wetin dey happun for di kontri at di moment even if di time dey hard.

E say tins go still dey beta for di kontri as e dey try im best to provide wetin Nigerians need.

President Tinubu say make di pipo of Nigeria get faith for im goment as e dey work to make di economy beta.

Di president also tok on di issue of subsidy removal wey affect many Nigerians.

President Tinubu yarn dis one for im new address to Nigerians wey im post for im X handle on Wednesday 7 August 2024.

President Tinubu removal of di controversial fuel subsidy wen e enta office for May 2023 don throw many Nigerians into a struggle to survive due to inflation wey don reach di kontri highest figure in three decades.

For ova five days , many youths across Nigeria hold demonstrations and ask di goment to address concerns around rising cost of living, corruption and unemployment.

Di protests wey dey peaceful for some states don also witness alleged extra-judicial killings by security operatives especially for Nigerian northern states of Borno, Jigawa, Kaduna, Niger and Kano.

We dey update dis tori

Source