Chidimma Adetshina withdraw from Miss South Africa 2024 pageant afta citizenship controversy

Miss South Africa 2024 contestant Chidimma Adetshina don withdraw from di pageant.

Dis withdrawal dey come afta one report from South Africa Home Office wey say indications dey say her mama commit fraud and identity theft in registering her wen dem born am.

Chidimma bin face question about her eligibility to contest for di pageant sake of questions around her citizenship.

Di questions make organisers of di pageant put a request to di Home Office to investigate di mata.

“I don make di difficult decision to withdraw mysef from di competition for di safety and wellbeing of my family and I,” Chidinma tok for her Instagram press statement.

Chidinma Adetshina write for Thursday 8 August 2024 2024 say to be part of di Miss South Africa competition na good journey for her.

She say pipo bin stand by her wen she start di journey but she need to take a decision to comot for di contest.

Chidinma say her decision to comot di competition na sake of di safety of her family and hersef.

“To dey part of di Miss South Africa 2024 competition na amazing journey. Afta much careful consideration, I don make di difficult decision to withdraw mysef from di competition for di safety and wellbeing of my family and I,” she tok for her post.

“Wit di support of di Miss South Africa organisation, I dey comot with a heart full of gratitude for dis amazing experience.”

She add say anyone wey win di contest go represent di entire contestants.

Wetin Home Affairs bin tok

She dey among 10 women wey go participate for di competition wey go hold for di capital Pretoria, dis Saturday

According to di Department of Home Affairs, on Monday 5 August 2024, di organisers of di event bin send di department one request to verify di citizenship of one contestant, Chidimma Adetshina.

Dem say dis request dey accompanied by written consent from both Adetshina and her mama.

Department of Home Affairs, for dia preliminary findings allege say:

  • “Prima facie reasons exist to believe say fraud and identity theft fit don deycommitted by di pesin recorded in Home Affairs records as Chidimma Adetshina’s mama;
  • “Adetshina no participate for di alleged unlawful actions of her mama, as she be pikin at di time wen di activities take place for 2001;
  • “One innocent South African mama, wey her identity fit don dey stolen as part of di alleged fraud committed by Adetshina mama, suffer as a result becos she no fit register her pikin;
  • “Di Department don broaden dia investigation to identify and pursue any officials wey dey involved for di alleged fraudulent scheme, and dey obtaining legal advice on di implications of di alleged fraudulent activity on Adetshina citizenship status; and
  • “Upon di completion of di investigation, Home Affairs intend to press criminal charges against all implicated parties.”

Di Department of Home Affairs tok say e get some ongoing tok-tok wit all stakeholders wey include Adetshina mama.

Chidimma mama and family neva comment on di latest findings by di Department of Home Affairs.

Di Miss South Africa 2024 go be di 66th edition of di pageant and di grand finale go hold on Saturday, 10 August 2024 for Pretoria.

According to wetin dey di Miss South Africa website, eligible contestants and “applicant need to be South African citizen and get valid South African passport.

Na di 2023 winner of di beauty contest Natasha Joubert of Gauteng go crown her successor for di end of di programme and na di winner go represent South Africa for Miss Universe 2024 pageant wey go hold for Mexico.

Source