‘I call my son to come die’ – Woman share how her son die for Kano protest

Protests against hardship and hunger for Nigeria wey start for August 1 don kill some pipo and among dem na 21 year old Ismail Muhammad.

Im mama bin make am follow her join di protests for Kano State, north-western Nigeria but dem shoot and kill am di same day.

Dia family of 20 don dey struggle to survive and as first pikin, plenti of di responsibility dey for Usman hand. E include di three wives wey im papa, wey be former political party chairman for local goment, bin marry.

Even though Usman bin plan to join di protests, wen im mama dey comot house dat Thursday morning, e neva ready. But she continue to dey call am for phone as dem see di only way to show dia vex for di hard economy na to protest.

Maryam, im mama tell BBC say, “I call my son to protest ground, wetin I no know be say I bin dey call am to come die”. She bin dey call am to make sure say e comot house come join am for di #EndBadGovernanceinNigeria protest.

Di day bifor, “im bin comot one of im shoes, blue jeans and white shirt keep outside” to prepare for di protest, Maryam tok. On di protest day, dem suppose join di procession wey bin dey go Kano State goment house.

Dia, dem bin dey expect to hala dia vex give di state govnor or whoever come see dem. But she tok say e no too tey afta dem tanda outside goment house wey security officers start to dey fire dem wit tear gas.

Na di last time wey she see Usman be dat.

Maryam, wey dem bin help enta okada to go house tok say “smoke from di tear gas and shooting start. I bin dey fear so we run”. Bifor tori come sef, she feel say her pikin die for di kasala wey she run from.

She say, “From wen di shooting happun, my heart start to pain me, and I just know say somtin bad don happun.”

Wen she last follow Usman tok bifor di protest, she bin tell am how hard life don be sotey she neva cook food for four days.

Maryam tok say, “e tell me say our wahala go end wen e become health worker”.

Usman bin study for nursing diploma for di State school of nursing but bin no fit get work for di health sector, im mama get am work wit her brother wey dey sell cloth for di market.

For two years wey e bin work wit im uncle, Usman bin make 45,000 naira ($30) monthly and half dey go for food for di family. According to Maryam, e bin also dey help to pay im siblings school fees.

Di day bifor di protest, wen im just get im salary, e bin pay some gbese wey im family bin get to buy food stuff. Di remaining of im salary bin dey im pocket wen dem shoot and kill am. But wen dem bring im bodi come, di money bin no dey again, im mama tok.

Dem bin shoot am for two places, im back and im shoulder.

Maryam say, “im death go forever be scar for my heart. We want justice for am from di goment”.

On Sunday, Nigeria President Bola Tinubu tok for speech say im sabi say pipo die for different parts of di kontri on top di protests. But police still dey drag to tok say pipo die especially from dia bullets.

Wen BBC follow Kano State police tok-tok pesin, Abdullahi Haruna Kiyawa, tok, on top Usman death, e say di operation na collabo wit oda security agencies.

So, e tok say e make am hard to find who gan-gan kill di young man.

Source