‘We go work out plans for affected passengers’ – FAAN tok after authorities ground Arik Air

Di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) don react afta one of di major airline for Nigeria Arik Airline go stop to fly for now sake of debts wey dem owe.

Arik Air na privately Nigerian owned commercial airline wey dey fly different routes for di kontri.

Dis na as di Nigerian Airspace Management Agency (NAMA) bin stop aircraft of Arik Airline from flying sake of legal actions against dem.

Wetin happun be say di FCT High Court bin enforce one order wey di court bin make ontop one debt of $2.5 million wey Arik Airline dey owe one Atlas Petroleum International Ltd.

According to FAAN, di issue na between Arik Airline and dia creditor and di action go affect passengers wey don already book flight.

“Dis na to inform di public say di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) dey aware say Arik Airline don dey stopped from flying sake of legal issues between di airline and dia creditors.”

Di serious gbege now na how passengers wey don book flight for di ariline go take sort diasef sake of di new development. Di airport authority say Arik go need to find how dem go work to transfer passengers go oda flights wey dey available.

FAAN through dia Director of Public Affairs and Consumer Protection, Mrs Obiageli Orah say, di “authority don ask all airport managers across di kontri to assist di affected passengers as Arik Airline go work out plans on how dem go rebook and transfer passengers to oda available flights.”

Wetin Arik Air tok

Arik Airline don issue information give dia passengers wey don book flights say all di flights don dey cancelled.

Di airline say di cancellation na sake of di directives wey stop di aircraft from flying.

“Due to di ministerial directive wey stop our aircraft from flying, all our flight operations for today don dey cancelled,” di airline tok for dia website.

For 2017, Ethiopian Airlines wey be one of di biggest airline for Africa, bin declare say dem go like to take ova Arik Air and one oda airline for Nigeria..

Dat time, Nigerian goment say Arik Air dey broke and no get money to do business and dem want oda pipo to manage.

Esayas Weldamariam, wey be di director of International Service for Ethiopian Airlines Group dat time bin say dem ready and dey capable to make sure say Arik Air dey successful.

For February 2017, Arik Air also enter news after dem no fit pay di salary of dia workers. Nigerian goment bin take ova di company dat time.

Source