US Embassy issue new directives for Nigerian visa applicants

Pipo wey dey travel

Getty Images

Di United States Embassy for Abuja and di Consulate General for Lagos dey move go new visa services provider on 26 August.

Dis na according to one statement on dia website dem publish on Wednesday, 31 July.

Di embassy assure applicants say all non-immigrant visa interview appointments remain valid.

Dem add say no action go dey needed for interviews wey fall on or before 16 August.

Dis one mean say any interviews wey fall on or before 16 August fit use di current service provider.

“If your interview dey scheduled on or before August 16, 2024: No further action dey required. You fit continue to access your account at ustraveldocs.com to review your appointment details and contact customer service as necessary,” di statement tok.

Wetin to do if your appointment fall afta 16 August

According to di statement; If your interview dey scheduled between 16 August and August 26, 2024, di applicant no go fit access dia ustraveldocs.com account.

Dis one mean say di applicants no go fit cancel or reschedule dia appointment from August 16, 2024, and dem no go get access to customer service.

Di embassy advise say make di applicant print im appointment confirmation letter before 16 August and attend di visa interview if possible.

Dem add say if di applicant fail to appear for im scheduled interview, make e check back afta 26 August, for instructions on rescheduling im appointment.

Wetin to do if your interview dey scheduled for 26 August, 2024, or afta

No further action dey required, but you no go fit access your ustraveldocs.com account afta August 16, 2024.

Dis one mean say you no go fit cancel or reschedule your appointment from August 16, 2024, and you no go get access to customer service.

Beginning 26 August 26, 2024, di embassy go get new visa services website and you fit update your information wen you create a new user account.

You go need to create dis new account to review your account information, make changes, submit requests, or contact customer service.

For interviews on or afta 26 August, print your appointment confirmation before 16 August. Visit di new visa services website from 26 August to create a new account.

Approximately about 605,000 Nigerians dey live for US, according to di data wey di US Census Bureau reveal for September 2023.

Di data tok say Sub-Saharan Africa alone population na 2.3 million and Nigeria get di highest single source of Africa migration to di US, followed by Ethiopia (325,214), Somalia (221,043), and Ghana (172,558).

Source