Who be Imane Khelif wey scata Italian opponent Angela Carini in 46 seconds for Paris Olympic boxing bout

Imane Khelif

Getty Images

Di last 24 hours for di Paris Olympics bin dey dominated wit tori about one female Algerian boxer wey scata im Italian opponent for dia opening boxing bout in 46 seconds.

Imane Khelif wey be 25 years bin land heavy punch for Angela Carini face inside di first 30 seconds of di bout.

Na so Carini no fit recova to continue di fight – di referee bin raise Imane Khelif hand as di winner of dat fight.

Carini bin dey cry afta di fight and say she neva receive dat kind punch for her entire life bifor.

Im tok BBC Sport say, “I neva fit to finish di match; I don dey feel strong pain for my nose; for di experience wey I get, I tok mysef say I hope my kontri and my papa no go take am badly.”

Di 25-year-old tok say “dis fit to be di match of a lifetime but I gatz preserve my life for dat moment”.

“I neva dey fear di ring, I neva dey fear to take blows but dis time I end am sake of I no fit to continue.”

Afta di match, social media don begin dey tok.

Pipo now start to dey ask questions say why dem allow Imane Khelif to compete for di games afta im fail testosterone test for di women’s world championships last year.

Angela

Getty Images
Angela Carini bin give up afta 46 seconds of di bout afta im nose break

Some bin dey tok say dem allow transgender pesin to compete inside women sports.

Italian prime minister Giogia Meloni don tok Italian media say “e dey mata say pipo gatz compete for equal grounds and from wia I dey stand, dis neva be even contest”.

“Na fact say wit di level of testosterone wey di Algerian athlete get, di race neva dey fair. I tink athletes wey get male genetic characteristics for neva dey allowed for women competition,” Giogia Meloni tok.

Khelif wey dey hope to win gold for di tournament bin dey disqualified from di women’s championship togeda wit Taiwan athlete Lin Yu-Ting sake of say dem fail eligibility criteria for 2023, according to di International Boxing Association (IBA).

Even though di IBA neva specify di exact tests wia dem fail, one of di eligibility criteria na say athletes wit male XY chromosomes no for participate for women competitions.

Di two athletes – Khelif and Lin neva dey identified as transgender or intersex.

Last year, di International Organizing committee (IOC) strip di IBA of im recognition ova governance and finance wahala – as di IOC now bin dey run di boxing competition for Paris.

Di IOC be di bodi wey clear di two boxers say dem fit participate for di 2024 Olympics.

Khelif

Getty Images
Di Algeria Olympic committee say di attack on dia champion dey unfair.

International Olympic Committee react to di tori

Di IOC inside one statement tok say dem no dey happy about di abuse wey di two athletes don dey get.

“Evri pesin get di right to practise di sport witout discrimination.

Di IOC tok-tok pesin Mark Adams for press briefing afta di games on Thursday tok say “testosterone neva be perfect test – plenti women fit get testosterone wey bin dey like wetin men get, but dem still be women and dey compete as women”.

“So dis idea say you go do one testosterone test and dat be all, neva get to be di case,” Mark Adams tok.

Im add say “each sport gatz deal wit dia issues and make di test to meet all di needs”.

“Dis dey involve real pipo and dia lives, dem don compete and continue to dey compete for di women competition; dem don lose and win some of dia fights against oda women ova di years,” Adams tok.

Adams add say “dis neva be transgender mata, evribodi sabi dis one, but some pipo don misreport di mata”.

“I gatz tok am again say dis neva be transgender mata, dis na women wey bin dey participate for competitions for many years.”

Khelif

Getty Images
Di Algerian boxer get three gold medals for continental championships wey im dey wan win some for di Olympics

Algerian Olympic Committee say di attack on Khelif na propaganda

Di Algerian Olympic committee for one statement ahead of di controversial bout, condemn di attacks on Imane Khelif.

Dey don describe dem as “lie lie and unethical targeting and maligning of our esteemed athlete wit propaganda wey get no basis”.

Afta di fight and di tok-tok wey bin dey go on, di Algerian Olympic and sports committee for one statement tok say dem go protect dia champion.

Inside di statement, dem tok say “di international Olympic committee don reaffirm dia commitment to ensure say all di athlete wey dey participate for di 2024 Paris Olympics comply wit di eligibility and compliance rules. Na so our athletes including our champion Khelif, don always follow dis regulations for all international competitions.”

“We dey strongly support our heroine and continue to defend her rights as a fair and qualified competition,” di Algerian Olympic Committee tok.

Wetin we sabi about Imane Khelif

Imane Khelif na female Algerian athlete wey be UNICEF ambassador for children and girls for im kontri.

She dey serve as role model for young pipo say make dem enta into sports and change di lives of dia family.

Afta dem make am UNICEF ambassador on 31 January 2024, Imane tok say she go use di opportunity to inspire young pipo say make dem “follow dia dreams and make dem no let any wahala stop dia dream. I wan make girls for Algeria see say dem too fit to do am”.

Imane inside one documentary about im life and career bin tok about how she help her mama sell bread for street inside her village wia she struggle to make am.

“Afta I bin sell di bread, I go collect dishes and oda tins for pipo wia dem go pay me moni wey I dey take move around sake of my my family bin dey poor.”

Pictures of Imane as she be pikin begin dey comot for social media as dem show her dey wear earrings, female clothes wia dem braid her hair wit ribbons.

Imane for dat documentary tok say she dey inspired to go into boxing afta her coach see say she get di “physical qualities” di time she dey school as a young girl.

“Na pure chance wey I take enta boxing, I neva imagine am say one day I go become boxer wia I go become world champion.”

“I bin love football well well wey I play for my village. My papa dey like both football and boxing, na so I choose boxing afta my teacher tok say I get di qualities,” Khelif tok.

Khelif also tok how di disqualification from di women’s championship last year vex am well well.

“2023 na difficult year for me afta say tins don go well until di disqualification – but I don bounce back to show my strength and determination and to show di world say na brave woman Khelif be.”

Imane bin represent Algeria for two consecutive Olympics – wia thru out her career, she get 51 fights wit 9 defeats.

Out of di 5, she win 42 wey dem later disqualify 4 out of di number.

For di 2018 world boxing championship, Khelif finish for 17th position wia she enta top seven for di 2019 tournament.

Di 25-year-old finish for di quarterfinal stage for di Tokyo 2020 Olympics.

Later, Imane Khelif bin participate for di women’s world boxing wia she win silver medal.

Now, she get three gold medals for di 2022 African Championships, Mediterranean Games and di 2023 Arab games.

For 2023 wen dem disqualify Imane for di IBA Women’s World Boxing Championships sake of say she get high testosterone levels inside her bodi but di International Olympic Committee bin clear di 25-year-old to compete for dis Paris Olympics wia she dey hope to win anoda medal.

Khelif go face Anna Luca Hamori from Hungary for di 66kg quarterfinals on Saturday.

If she win, Khelif dey guaranteed for Olympic medal.

Hamori tok di BBC World Service sport say, “My mentality na say make I neva give up, no mata wetin happun.”

“As Carini abandon her fight wit Khelif, na her own choice – I fit to promise you say I go fight to di end, we go see wetin go happun,” di Hungarian athlete add.

“I neva sabi wetin be di truth but I no care. I just wan win.”

Source