Indonesia plane crash: Sriwijaya Air passenger plane dey miss minutes afta take-off

Relatives of passengers on board missing Sriwijaya Air flight SJY182 wait for news at the Supadio airport in Pontianak on Indonesia's Borneo island on January 9, 2021, after contact with the aircraft was lost shortly after take-off from Jakarta.

AFP
Relatives for di aircraft intended destination dey wait anxiously for news

One passenger plane wey carry 62 pipo fit don crash into di sea shortly after take-off from Indonesia capital, Jakarta.

Di Sriwijaya Air Boeing 737 lost contact four minutes into di journey to Pontianak for West Kalimantan province, na wetin officials tok.

Flight tracking website Flightradar24.com tok say di aeroplane don lose more dan 3,000m (10,000ft) for altitude in less dan one minute.

Witnesses say dem bin see and hear at least one explosion.

Fisherman Solihin, who dey ansa one name, tell BBC Indonesian service say im witness di crash and e captain decide to return to land.

“Di plane fall like lightning into di sea come explode inside water,” im tok.

“E bin dey close to us, di body wey be like plywood almost hit my ship.”

A number of residents for one island near where di plane disappear tell di BBC say dem don find objects dem tink say fit be from di plane.

Di transport ministry tok say search and rescue efforts don start.

Dem don deploy Indonesian navy to look for di aircraft, according to reports. Navy official Abdul Rasyid tell Reuters news agency say dem don find di plane coordinates and dem don deploy ships to di location.

Di plane no be 737 Max, di Boeing model wey don involve for two major crashes of recent. Dat model dey grounded since march 2019 until las December sake of those two major crash.

According to registration details, di plane na 27-year-old Boeing 737-500.

Sriwijaya Air, na local carrier, and dem tok say dem still dey gada informate about di flight.