Trump doctors give am dexamethasone afta im oxygen level drop

Donald Trump

Reuters
President Trump dey wave as e dey head to di hospital

United States Presido Donald Trump don begin take steroids afta im oxygen level drop.

Oga Trump doctor, Sean Conley say dem give di president im first dose of steriod wey dem dey call dexamethasone, on Saturday,

Dexamethasone na medicine wey dem dey give patients wey get critical Covid-19, so dat dia liver go fit to function.

Dem tok say dem give am more oxygen even afta Trump say im no need am.

Donald Trump oxygen level don drop two times since Thursday, even as Dr Conley say dem fit discharge am on Monday to continue im treatment for White House.

On Saturday, President Trump doctors say im dey receive beta treatment from different medical specialists.

Dem say dem dey monitor am seriously “for any evidence of complications” but im neva get any fever since Friday morning.

Di doctors say dem don check im kidney, liver and heart functions and all of dem dey okay.

Dem dey observe for any kind of inflammation wey dey common wit di virus infection.

How many pipo don catch Covid-19 for White House?

Wen American Presido Donald Trump tweet say im and im wife Melania don catch corona virus on Friday, di news shock di world.

Now as im don dey hospital, eye dey chook who else don test positive.

Oga and madam Trump test positive for di virus afta di presido communications director Hope Hicks,The pp catch di virus, and she bin no dey di event.

As e be so, seven of di pipo wey attend di event don test positive for Covid-19 including di president and im first lady.

Kellyanne Conway

Kellyanne Conway wey bin don resign as White House senior adviser for August don catch di virus.

Na she herself confam am on Friday say she test positive.

Mike Lee/ Thom Tills

Both of dem na Republican Senators, Mike Lee na senator from Utah while oga Tillis come from North Carolina.

Dem two join confam dia positive test result for coronavirus for Twitter.

At least seven pipo wey go di event don test postive for covid-19

Getty Images
At least seven pipo wey go di event don test positive for covid-19

Reverend John Jenkins

Rev. John Jenkins wey be di University of Notre President also catch di virus.

Tori pesin

One journalist wey attend di Rose Garden event also follow catch di virus.

But, di White House Correspondents Association wey report di tori no drop im name.

Plenti eyes don dey chook put di Rose Garden event wey Oga Trump use nominate im pick for Supreme Court Judge, Amy Coney Barrett.

Tori be say all of di pipo wey bin go di event no wear facemask, dem no implement social distancing and some pipo dey shake hand, even hug sef.