UK, US, Canada cut warning give dia citizens as organisers insist on planned protest

Nigerian protesters

Getty Images

Some foreign missions for Nigeria don dey cut warning give dia citizens sake of di nationwide protest wey some youth groups dey plan to start on 1 August.

Di kontris include di United States of America, di United Kingdom and Canada.

Di US ask dia citizens to “monitor local media for updates, avoid crowds, avoid demonstrations, be aware of your surroundings, review your personal security plans and keep your cell phone charged in case of emergency, and carry proper identification”.

Also, di website of di Canada embassy for Nigeria tell dia citizens say di planned protest “fit disrupt traffic and public transportation and e fit turn violent at any time”.

“If you dey for Nigeria, dey expect a heightened security presence and remain vigilant at all times,” dia statement tok.

Di UK update dia usual security warning and tok say “widespread public demonstrations are a possibility across Nigeria”.

Dis warnings dey come as some of di youth groups wey dey plan di protest tok say dem gatz do am no mata wetin goment tok.

“Young pipo don tire and dem need to express dia displeasure against goment malfeasance,” Damilare Adenola, one of di leaders of di ‘Take It Back Movement’, a group wey dey on top di plans for di protest, tok for television on Sunday evening.

But di goment don call for di protest not to hold sake of fears of wetin happun during di ‘End SARS’ protest of 2020 wia, according to goment, hoodlums hijack di demonstration and use di opportunity to destroy goment buildings and facilities worth billions of naira.

Police withdraw men on special duties

For days now, di Nigeria police don dey issue “guidelines” on how dem want di protest to happun if di organisers insist say dem no go call am off.

Di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, bin tok say leaders of di protest go submit dia names and contact details to di police, and also say di protest no go dey pass 4pm evri day.

For Rivers State, South-south Nigeria, di police commissioner Olatunji Disu tok say dem don prepare well for any eventuality.

“We no go want make e be a situation of we versus dem, wey dey in dis togeda. We don tell di officers wetin to do, we don withdraw our men from special duties we don tok to dem, we don train dem again and again, we dey ready to hold any situation we present itself to us,” oga Disu tok.

State govnors engage youth groups

Also, govnors of various states don dey engage personally wit youth and student groups for dia states to ask for calm.

For Osun State, govnor Ademola Adeleke go meet wit di representatives of civil society organisations, student bodis and security chiefs “for a dialogue session on govnance for di kontri”, according to one statement by im tok-tok pesin Olawale Rasheed on Monday, 29 July.

Also, Alex Otti, di govnor of Abia State beg di youth to “tink about di implications of pouring out into di streets, restricting di movement of oda pipo, and possibly inflicting harm and more hardship on di pipo”.

“My advice be say make pipo no pour out for di streets becos e fit dey more harmful dan di reason for di protest wey pipo dey call for.”

‘No threaten protesters’ – Amnesty International

Di international human rights group, Amnesty International (AI), don tell di Nigerian goment to stop to dey threaten protesters.

Auwal Musa Rafsanjani, di Chairman of AI for Nigeria tok say even though dem no dey call for violence of any kind, dem believe say “goment get di duty to protect di protest itsef becos e follow for democracy”.

“Di (Nigerian) President know veri well as a democrat, as sombodi wey don participate for previous protests, e know di value and importance.

“Wetin I tink dey happun now be say di international community and Nigerians dey watch and dey see dis utterances by hired pipo to bring religious connotation to di protest,” e tok.

Source