Wetin Whatsapp tell us about tori say dem fit comot Nigeria sake of data breach and consumer protection allegations

Meta Logo

Getty Images

Meta, di parent company wey get Facebook, Whatsapp, and Instagram don tok say di order to pay fine of $220 million wey di Nigeria goment sama dem “contain plenty inaccuracies” and e fit get impact on users of di platform for Nigeria if goment no overturn am.

Dis na dia response to di question wey BBC Pidgin ask Meta on Friday about di tori wey don spread for Nigeria say Whatsapp fit comot for Nigeria.

Whatsapp na one of di most popular instant messaging social media app for di world and millions of Nigerians dey use di platform on a daily basis.

However, di Nigerian Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) dey accuse di company say dem violate Federal Competition and Consumer Protection Act (FCCPA) and di Nigeria Data Protection Regulation (NDPR).

Di allegation be say Whatsapp “dey deny Nigerians di right to control dia personal data, dem dey transfer and share Nigerians data without authorisation, and dem dey discriminate against Nigerian users compared to users for oda jurisdictions”, among odas.

We go block any Loan App wey harass customers – FCCPC

Some tori pipo for Nigeria bin report say Whatsapp don threaten to comot for Nigeria sake of di big fine wey goment sama dem, so BBC Pidgin bin ask Meta for clarification.

AT3 Resources, di PR firm wey dey tok for Meta for Nigeria send us dis statement:

“WhatsApp dey rely on limited data to run our service and keep users safe, and e go dey impossible to provide WhatsApp in Nigeria, or globally, without Meta infrastructure. Dis order contain multiple inaccuracies and e dey misrepresent how WhatsApp take dey work and we dey urgently appeal di order to avoid any impact to users.”

We send anoda question asking categorically weda Whatsapp dey plan comot for Nigeria, but dem neva reply yet.

Meanwhile, di FCCPC bin don respond to di initial report say Whatsapp dey threaten to comot for Nigeria.

For dia official X handle, di commission tok say dat one na strategy wey Whatsapp wan take influence public opinion and pressure dem to reconsider dia decision.

“Di action wey FCCPC take dey based on legitimate concerns about consumer protection and data privacy… Oda jurisdictions dey take similar measures and e no dey force companies to leave di market. Nigeria case no go dey different,” di FCCPC statement tok.

Wetin be FCCPC and wetin dem dey do?

Adamu Abdullahi

BBC

Di Federal Competition & Consumer Protection Commission, FCCPC wey dem bin call di CPC bifor na di leading competition and consumer protection agency for di Federal goment for Nigeria.

For one interview, di Oga of FCCPC, Acting Chairman Adamu Abdullahi bin tell BBC Pidgin say dia work na to make sure say fair competition dey among di pipo wey dey sell and make buyers also get wetin dem want at affordable prices and quality.

“Our work na to make sure say open market dey. Anytin wey e cost you to produce your product, sell for dat price. Na quality go decide di price of goods but we go also chook eye for di quality of di product. If we see any product wey be fake our law say we fit clear am.”

Oga Abdullahi bin also ask Nigerians for dat interview make dem no keep quiet if dem see or experience anytin wey dey against consumers.

Im say di way to reach dem sharp sharp na to do video post for social media and tag dem.

You fit also enta dia website write your complain dia or you fit still write to dem directly and address am to any of dia office for your geopolitical zone.

“As e dey happun, make you do video post am for all our social media handles, e dey work and e dey faster”.

Source