Olympics football 2024 quarter-final fixtures

Morroco dey celebrate olypmic game win

Getty Images

Di quarter- final round of matches for Paris Olympics games go start on Friday 2, August for men and Saturday 3 August for di women.

Two African kontris dey amongst di last eight teams.

Check out di quarter- final fixtures below.

Men Olympics quarter-final fixtures

Friday August 2

France vs Argentina

Stade de Bordeaux, kick-off 8pm

Match facts

Dis na di first time wey France and Argentina dey meet for di men Olympic football tournament.

France no face South American opposition for di Games since dem defeat Brazil 2-0 to win dia first gold medal for Los Angeles 1984.

Morocco vs USA

Parc des Princes, Paris, kick-off 2pm

Match facts

Dis na Morocco first-ever knockout game for Olympics.

USA win dia most recent quarter-final match, dem defeat Japan on penalties afta di match end for 2-2 draw at Sydney 2000.

Egypt vs Paraguay

Stade de Marseille, kick-off 6pm

Match facts

Egypt don reach di quarter-final stage for dia last three visits to di Olympics Games.

Paraguay most recent appearance for di last eight na a 3-2 victory ova Korea Republic for Athens 2004, di South Americans be eventually go on to win di silver medal.

Japan vs Spain –

Stade de Lyon, kick-off 4pm

Match facts

Di two teams bin meet for di knockout stages of Tokyo 2020. Spain progress on dat occasion, dem bin defeat Japan 1-0 for semi-final.

Japan bin don win three of dia previous four quarter-final ties for di Games.

Women quarter-final matches

Spain women dey celebrate Olympic game win

Getty Images

Saturday August 3

France vs Brazil

Stade de la Beaujoire, Nantes, kick-off 8pm

Hosts France go meet one of di best-ranked third-placed teams in Brazil. Di South American icon Marta, no go dey available for dis ogbonge game, afta she chop straight red card for her kontri  2-0 loss to Spain.

USA vs Japan

Parc des Princes, Paris, kick-off 2pm

Match facts

Four-time Olympic champions United States go take on Japan for wetin go be di 41st meeting between di two sides since1980s.

Di two sides bin meet for di gold medal match for London 2012, Di Americans narrowly win 2-1.

Japan neva match dat dia achievement yet, while for USA, na di last year dem top di podium be dat.

Spain vs Colombia

Stade de Lyon, kick-off 4pm

Match facts

Despite dia 1-0 loss to Canada on 31 July, Colombia make history for Paris as dem qualify out of group stages for di very first time.

Dem finish third for Group A, wit a better goal difference pass Australia and now dem go jam di world champions Spain.

Canada vs Germany

Stade de Marseille, kick-off 6pm

Match facts

Canada survive dia six-point deduction (sake of say dem use drone to scout dia opponent) dem finish second for dia group. E no go easy for di reigning Olympic champions, as dem dey take on Germany for di last eight.

Di Europeans go hope to match dia dream run for Rio 2016 wey dem top di podium

Source