Despite arrests, why Nigerians wan protest?

Members of civil society groups are holding a peaceful protest over economic hardship and unfriendly government policies to mark Nigeria Democracy Day in Ikeja, Lagos, Nigeria, on June 12, 2024. (Photo by Adekunle Ajayi)

Getty Images
Nigerians wan protest di economic hardship and the worse inflation rate in three decades

Khalid Aminu bin dey prepare to go one radio programme for Kaduna wen three secret police wey wear mufti come carry am from im hotel room go questioning.

E say e bin dey detained for six hours and dem ask am about di campaign e bin dey lead to create awareness about plans to protest for 1 August.

E tok say im lawyer gatz chook mouth inside bifor dem release am.

E tell BBC say, “I go still participate for di protest”.

Like am, Kano TikToker Junaidu Abdullahi (Abusalma) bin dey for jail for six days afta e make video wey e don delete say make pipo stand against anybodi wey tell dem say make dme no protest. Im lawyer say dem release am afta dem drag ear warn am.

Amnesty International as dia ansa to im arrest say, “to arrest critical voices no suppose be di priority of Nigerian authorities no wen millions almost dey starvation level and dey face widespread malnutrition and severe poverty.”

For protest wey dem call “End Bad Governance in Nigeria”, activists like Oga Aminu don dey arrange demonstration wey dey ask goment to give free education, end insecurity, declare state of emergency on inflation and tok wetin lawmakers dey make, among odas.

President Bola Tinubu don hala young pipo to no follow for di protest say na work of “sinister” pipo wey wan match leg on di kontri economic wahala.

Im administration start for shaky approval rating on top di fact say e win wit just 37% of votes for di 2023 election. Dis na di lowest wey any president don get in di history of di kontri.

E bin neva even win public confidence bifor im announce say e dey comot di expensive but popular electricity and petrol subsidies.

Dis plus di devaluation of di naira twice in one year increase di price of foods and transportation.

Oga Tinubu say di reforms bin dey aimed to increase foreign investment and stabilize di economy as time go on.

But poor pipo pocket don dry finish and carry tens of millions of already poor pipo don enta more inside poverty.

Insecurity mostly for di north wey be di agriculture centre, don pursue farmers and contribute to di increase din food prices.

Di price of food like rice, beans, tomatoes, potato and yam bin rise ova 250% between May 2023 and June 2024, according to di kontri statistics bureau. Dis don create anger wey don spread.

E bin ask for more time to fit implement im “pipo-centred” programmes don also approve new minimum wage of 70,000 naira ($44) as im dey wait for parliament to accept am.

Members of di House of Representatives too don gree say make dem half dia salary for six months.

Di Nigerian goment don also announce say dem go deliver grains to states, start di student loan programme and suspend tax for some imported food and launch new plant wey go assemble compressed-natural-gas-powered mass transit buses and keke so subsidy removal no go too bite pocket.

A stack of tomatoes, onions and pepper

Getty Images
Prices of major foods have over double in di past one year

But as inflation don reach 34% wey be highest in 28 years for June, some Nigerians feel like say e no dey enough to handle di economic wahala.

Dem say di political class no dey make di same kain sacrifice wey dem wan pipo make dem make. Dem want goment to reduce di cabinet and troway di lavish pay rises for civil servants, flashy cars and private jets for goment officials wey include di one wey dey proposed for di president office.

Feeling also dey say e dey enough to tackle corruption. Im poverty alleviation minister wey dey suspended sake of alleged diversion of money no help im case.

Oga Aminu tell BBC say e dey lead both di online and physical campaign bifor di protests so pipo fit speak up “against bad governance of di kontri and some policies wey feel say no dey right. Everyone dey feel am.”

Di 38 year old engineer say di kain vex wey Nigerians don feel for long and na why pipo wan carry dia nager enta street.

Authorities say dem dey fear di protest go turn violent.

Nigeria police oga don warn against di type protest dem do for Kenya, as im hint say Nigerians fit copy young Kenyans wey want make President William Ruto to resign, to force U-turn for tax hikes and comot almost di full cabinet.

Oga Egbetokun tok say, “some groups of pipo, wey call demselves crusaders and influencers, don dey arrange potential protesters to cause di kain kasala wey happun for Kenyan protests.”

Nigeria lass big protests na about four years ago, against one police unit wey bin dey accused of extra-judicial killings.

Di EndSars movement bin achieve im goal as dem disband di force but dem also face violent crackdown wia dozens of protesters bin dey killed.

President Bola Tinubu

Getty Images
Tinubu say e bin protest bifor bt peacefully.

So far, di planned march no get clear leaders wey pipo tink say na means to make sure authorities no target dem use am do koni koni negotiations.

But oga Aminu tok say while leaders no dey, coordinators dey.

E say “plenti outside arrangement dey to by al means to scata wetin we dey try do. Na why well meaning Nigerians need comot to arrange tins.”

Former presidential candidate, Omoyele Sowore don also dey mobilize as e call di protests “Days of Rage” and share fliers to gada online.

Some officials from di presidency wan finger opposition politicians like oga Sowore and Labour Party candidate, Peter Obi say na dem dey ginger anger for di protests but Labour Party don deny am.

Dis na as Information Minister, Mohammed Idris dey try calm donwn tension say di pipo wey dey ginger for protest “na our brodas, dem be our sisters”.

E say “dis na Nigeria family mata and all of us dey torchlight di issue well-well. We hope say peace go dey las-las.”

Former protests like EndSars don get kasla between demonstrators and security forces.

EndSars trauma still dey ground as di 1 August protests dey come. Pipo dey wey no go protests bicos of wetin dem carry eye see for 2020. Groups like National Association of Nigerian Students (NANS) also dey wey don denounce di protests.

Oga Tinubu tok say as opposition e bin also lead protests but e bin dey peaceful.

Next week, all di mouth of im democratic credentials wey im don dey make go dey tested, not only as Nigeria commander-in-chief but also as Ecowas chair.

Source