President Tinubu mourn business mogul Senator Ifeanyi Ubah

President Bola Tinubu don send condolences to di family of late Senator Ifeanyi Ubah.

Di tori of di death of di senator bin reach di public on Saturday 27 July 2024.

President Tinubu describe late Senator Ubah as renown business man and politician

Senator Ifeanyi Ubah na popular politician wey dey represent Anambra South Senatorial Zone for di National Assembly.

Senator Ubah na di Young Progressive Party (YPP) candidate for di 2021 November Anambra state govnorship poll, bifor e decamp go di All Progressives Congress (APC) for 2023.

Senator Ifeanyi Ubah on Anambra governorship election, Ipob and Nnamdi Kanu

Who be President General of Ohanaeze Ndigbo Emmanuel Iwuanyanwu wey die

South African actress Esta TerBlanche die at di age of 51

According to statement by di Special Adviser to di President, Ajuri Ngelale, Mr Tinubu describe di death as sad loss to Anambra state.

“President Tinubu dey commiserate wit di friends and colleagues of di late Senator, di National Assembly, and di goment and pipo of Anambra State ova dis sad loss.”

“Di President pray for di sleep for di soul of di departed lawmaker, as well as for strength and comfort to im family.” di president tok.

Dem born am on 3 September 1971 into di family of late Mr. and Mrs. Alphonsus Ubah of Umuanuka, Otolo, Nnewi.

E suppose clock 53 fully by September but death come early for am.

Senator Ubah enta oil and gas to become one very confam business mogul as e rise to become di Chief Executive Officer and Managing Director of Capital Oil and Gas Industries.

Na former member of YPP under wia e win election as senator bifor e join di ruling APC.

For 2014, im lose di di Anambra state govnorship election under Labour Party.

Na di founder of FC Ifeanyi Ubah football club and im also get one Foundation wey e dey use do philanthropic tins to help pipo for im community and outside di state.

Im bin escape assignation for for September 2022 for Anambra state.

Im dey married to Mrs Uchenna Ubah and dem born five children.

More condolences pour in for Senator Ubah

Govnor of Lagos state, Babajide Sanwo-Olu don also send im condolence to di family of di late senator.

“Di death of Senator Ifeanyi Ubah dey shocking and na tremendous loss for our kontri, as well as for im home state of Anambra.”

Govnor Sanwo-Olu say di good pipo of Anambra South dey mourn di death of one of dia ‘illustrious son”.

Senator Ifeanyi Ubah

BBC

For one exclusive interview e do wit BBC Pidgin den for September 2021, Senator Ubah bin call on south east govnors to take proactive approach and not to dey shy away for di mata of di insecurity for di eastern region.

Di senator bin accuse govnors for south east say dem no dey do enough on di mata on insecurity for di state.

Di senator tok bin come at a time di region record some high profile attacks and killings of pipo including security personnel.

For September 2022, na about five pipo bin die afta gunmen attack di convoy of Senator Ubah for Anambra state.

Di attack happun for Nkwo Enugwu-Ukwu, Njikoka Local Goment Area of di state and dii senator aide, Kamen Ogbonna confam di incident to BBC Pidgin den.

Viral video for social media bin show about three vehicles wit deadi bodi inside dem.

Ogbonna confam say di pipo wey die for di attack include di senator aides and police officers. But di senator wey bin dey inside bullet proof vehicle manage escape dat time.

Di attack on Senator Ubah wey be former governorship candidate of YPP for di 2021 govnorship election for Anambra state bin attract reactions for 2022 wit police condemning it.

Source