Rescuers dey bring out deadi body from mud afta landslide kill over 157 pipo for Ethiopia

A crowd gathers at the scene of a landslide in Ethiopia

Reuters
Fotos show hundreds of pipo gather at di scene

Rescue teams don comot di body of 157 pipo wey die for two landslides for southern Ethiopia, one local official tell di BBC.

Di landslides happun on Sunday evening and Monday morning, afta heavy rains fall for one remote mountain area of di Gofa zone.

Di local authority tok say di search for survivors go “kontinu vigorously” but say di “death toll fit increase”.

Foto show say hundreds of pipo gather for di scene and oda dig in di dirt in search of pipo wey dey trap underneath.

For di background, one hillside don partially collapse and large patch of red earth don expose.

Di chief administrator of Goza zone, Dagmawi Ayele, tell di BBC say pipo wey die include both adults and children, while dem rescue 10 pipo alive wey dey receive treatment for hospital.

Na heavy rain cause di landslide on Sunday, and as police officers, teachers and residents from nearby villages kontinu wit search-and-rescue operations on Monday, di second landslide happun, e bury dem too under di mud, Oga Dagmawi tok.

“We still dey dig”, e tell di BBC.

Gofa na part of di state wey pipo sabi as Southern Ethiopia, e dey around 320km (199 miles) south-west of di capital, Addis Ababa.

Southern Ethiopia na among di areas of di kontri wey don dey hit by particularly heavy rain and flooding in recent months, according to di UN Office for di Co-ordination of Humanitarian Affairs (Ocha).

But instances of landslides and floods don happun bifor.

For May 2016, at least 50 pipo die in floods and landslides following heavy rain across di south of di kontri.

Many factors fit contribute to flooding, but warming atmosphere wey climate change cause, fit dey cause extreme rainfall.

Di world don already warm up by about 1.2C since di industrial era start and temperatures dey kontinu to rise unless goments around di world make step cut to emissions.

Source