Arne Slot, Tuchel, Allegri, Moyes – Football managers wey dey take up new assignments or wey lose dia jobs

Jurgen Klopp and Arne Slot

Getty Images

As di 2023/2024 football season for Europe don end, some top football managers don dey know dia fate as some of dem don chop sack from dia jobs, some odas don get roles for bigger clubs, while a number of odas still dey look for clubs several months aftA dem comot from dia last positions.

Here na some of di managers wey don make significant moves ahead of di next football season:

Arne Slot in, Jurgen Klopp out

Relatively unknown coach, Arne Slot, go take over from jurgen Klopp for Liverpool afta Klopp say bye bye to di Anfield fans on Sunday.

E shock many pipo wen Liverpool announce Slot wey bi former coach of Feyenoord in di Netherlands Eredivise as di replacement for Klopp wey win eight major trophies for im nine years at Anfield.

However, tori be say Liverpool bin do proper research, wey include looking at data and character bifor dem choose Slot as dia preferred candidate.

Im record wit AZ Alkmaar and Feyenoord show say Slot na manager wey dey able to over-perform compared wit di resources im get, and e also get impressive record for developing players.

As for wia Klopp dey go next, nobody know yet.

David Moyes out, Julen Lopetegui in

Moyes bin take ova at West Ham on 29 December 2019, wen di club dey 17th on di EPL table wit only 19 points from 19 games played, but e lead qualify for European competitions three times, and even win di UEFA Europa Conference League in 2023.

Unfortunately, West Ham finish 9th on di table dis season wey mean say dem no go play European football next season, but e no dey clear whether dis follow for why Moyes decide to take a bow.

Former Real Madrid, Sevilla and Spain National team coach, Julen Lopetegui, don already agree to take over di hammers starting from next season.

Massimiliano Allegri out of Juventus

Massimiliano Allegri

Getty Images
Allegri (centre) lose im job even though e lead Juventus to Coppa Italia victory

Juventus sack Massimiliano Allegri just some days afta e lead di club to win di 2024 Coppa Italia over Atalanta, and dat na di 5th time e dey lift di trophy for im career.

Allegri bin dey in charge of Juventus from 2014 until 2019, and win five Serie A trophy and four Italian Cups for di five seasons e dey dia. E also reach di Champions League final two times.

E neva dey clear who go replace Allegri at Juve, but reports say di club dey move towards Thiago Motta wey do wonders wit Bologna dis season.

Thomas Tuchel out of Bayern Munich

Thomas Tuchel

Getty Images
Under Thomas Tuchel, Bayern Munich fail to win di Bundesliga for di first time after 11 consecutive wins

German giants Bayern Munich bin don win di Bundesliga 11 times back to back bifor dem hire Thomas Tuchel as dia head coach in 2023, so e dey safe to assume say Tuchel appointment na to win di Champions League.

However, Tuchel fail to win even di Bundesliga wey don become tradition for di Bavarians.

Dem also lose to Real Madrid in di semifinal of di Champions league. But di hammer wey nail Tuchel coffin na di embarrasing 2-1 loss to FC Saarbrücken in di German cup in November last year.

Bayern Munich still dey look for who go lead dia side into di next season, and di latest name for di least now na Vincent Kompany, di former Manchester City defender wey lead Burnley to relegation dis season.

Roberto de Zerbi out of Brighton

Roberto De Zerbi

Getty Images
Roberto de Zerbi qualify BHA for dia first eva European competition in 2023.

Di sack of Roberto de Zerbi na real shock for di man imsef as well as many fans of Brighton and Hoves Albion.

Afta De Zerbi replace Graham Potter in September 2022, Brighton finish for sixth position dat season and secure European qualification for di first time for dia history.

Tori be say di Seagulls dey look to hire Kieran McKenna, wey just win promotion to di Premier League wit Ipswich Town, as De Zerbi replacement.

Xavi out of Barcelona?

Xavi

Getty Images

Whether Xavi Hernandez go remain di Manager of Barcelona next season neva dey clear, as tori be say im and di club President Juan Laporta still dey do meeting to decide.

Xavi bin announce in January say im go comot for Barcelona for di end of di season, but in April, Laporta tok say di former midfielder don change im mind.

If Barcelona decide to let Xavi go, tori dey suggest say dem fit go for anoda of dia ex players, Rafael Marquez, or former Bayern Munich manager Hansi Flick.

Mourinho, Zidane, Flick… Still no get clubs

Jose Mourinho, Zinedine Zidane, and Hans Flick

Getty Images

Di trio of Jose Mourinho, Zinedine Zidane and Hans Flick na some of di top class football managers for di world we still neva get clubs after leaving dia last positions.

Of di three, Mourinho na di last to lose im job after FC Roma sack am in january dis year.

Zidane leave Real Madrid in 2021 after e tok say “di club no longer get confidence in me”.

Flick, on di oda hand, na di first German national team coach to eva be sacked from di job, after a run of poor form wey see Germany comot for group stage in di Qatar 2022 World Cup.

Tori get am say Manchester United fit dey look Zidane wit corner eye as di Red Devils still dey think wetin to do wit dia current manager Eric Ten Hang.

Also, Flick fit dey on im way to Barcelona, if di Spanish giants decide to say bye bye to Xavi.

As for di Special One – Jose Mounrinho – e bin don dey reported say Saudi Arabian side Al-Qadsiah bin show interest to sign am, but e no be like say dem don make any formal approach.

Source