Argentina beat Colombia to win 16th Copa America final

Argentina win di Copa America

Getty Images

Argentina beat Colombia to win dia 16th Copa America afta goalless 90 minutes wey enta extra time.

Dis na afta dem delay di game for some minutes sake of some mata wey dey happun outside di stadium.

Na goalless draw di two teams in play for 90 minutes bifor e enta extra time wey give Argentina di chance to win.

Na Lautaro Martinez score di only goal for di Argentine team. E strike for di second half of extra time from di side wia Giovani lo Celso pass di ball through.

Di night dey wit tears for Lionel Messi wey wunjure imsef during di game wen im bin dey run follow di ball. Na Nicolás González bin replace Messi.

Nahuel Molina bin also replace Gonzalo Montiel sake of injury- dis delay di match small.

Bifor di game start small kasala happun for di stadium.

Na game of few clear chances inside hot, sticky conditions, wit Colombia Jhon Cordoba hitting di woodwork for first half.

Argentina think say bin think say dem dey lead inside 15 minutes but Nicolas Tagliafico effort dey ruled out for offside.

Martinez end up as di hero – and win di Golden Boot wit five goals.

Lionel Messi

Getty Images
Lionel Messi

Di organisers first warn say make pipo wey no get ticket comot for di venue but dem still try wan force diasef enta.

Na di kasala leave some fans to stand for some hours for di Miami heat stadium sake of say dem di gates neva dey open.

Na serious gbege between fans and police officers as dem clash.

Dem also make some arrests for di venue even as some fans gatz receive treatment from paramedics.

Di half-time break last for about 25 minutes sake of di concert by Colombian popstar Shakira wey perform for di pitch– even though Colombia coach Nestor Lorenzo no like di idea bifor.

Di game come wit different chances for di two teams.

For di 62 minutes, Colombia miss one attempt afta Jefferson Lerma play one correct shot from outside di box but e dey too high. Na Luis Díaz give Lerma di assist from a clear position.

Ángel Di María bin win one free kick for di attacking half for Argentina but dem no convert am to goal.

Di Maria also dey instrumental for di game as e create some chances for Argentina.

Afta long hours of play, di two teams enta extra time wit no goal.

But di magic come for di 112minutes (extra time) wen Martinez put di ball behind Colombia goalkeeper and dem maintain di lead to win di tournament.

Source