Why EFCC dey afta Yahaya Bello and di drama to gbab am

Di EFCC don tok say dem go use every legal means, to bring di former govnor of Kogi State, Yahaya Bello to court to answer case of corruption wey dem dey accuse am of.

Yahaya Bello no show for court on Thursday as di EFCC bin wan arraign am sake of allegations of corruption.

On Wednesday, some policemen and supporters of di former govnor bin block EFCC operatives wey bin go to arrest Mr Bello for im house for Wuse Zone 4, Abuja.

For court on Thursday, EFCC lawyer, Kemi Phinero, tell Justice Emeka Nwite say di former govnor dey protected by pesin wey get immunity, and e make am difficult for dem to serve di accused pesin.

However, Yahaya Bello lawyer, Abdulwahab Mohammed, tell di court say di EFCC never serve dem formally wit di court charges.

Attempts by Phinero to serve di court proceedings on di defence counsel on behalf of di defendant, no yield fruit.

After plenty arguments, di EFCC counsel tok say “we go make efforts to produce di defendant in court, even if e go take using di military. Immunity no reach for property or car”.

Phinero tok say if dem dey able to produce di defendant in court before di next adjourned date, di issue of service go don become academic.

E ask di court to adjourn di mata for ruling on substituted service and/or arraignment, but counsel to Yahaya Bello ask di court to adjourn only for ruling.

Justice Emeka Nwite adjourn di mata to April 23 for ruling on substituted service, and/or arraignment.

Why EFCC dey go afta Yahaya Bello and di drama to get am

Drama shele on Wednesday for di Wuse Zone 4 area of Abuja di Nigeria capital, wen operatives of di Economic and Financial Crimes Commission bin wan arrest di former Govnor of Kogi State Yahaya Bello.

Some EFCC pipo bin lay siege for Yahaya Bello domot for almost 10 hours make dem arrest am, but some policemen and plenty supporters of di former govnor no gree dem enta di building.

Hours later, di current Kogi State Govnor Ahmed Usman Ododo, arrive for di scene and afta e don spend some hours inside di building, e drive comot.

EFCC later tok say “Govnor Ododo don whisk Yahaya Bello away from di building”.

According to di anti-corruption agency, dem get an arrest warrant against Yahaya Bello so dat dem go fit arraign am before justice Emeka Nwite of di Federal High court Abuja over allegations of corruption wey pass N80 billion.

Di arraignment later go ahead but Yahaya Bello no appear for court as e succeed to dodge arrest on Wednesday.

Efcc operatives for Yahaya Bello house

BBC
EFCC operatives lay siege for Yahaya Bello domot for wetin pass 10 hours on Wednesday but dem no fit arrest am

Case against Yahaya Bello

Di EFCC bin don file corruption charges of about N10 billion against allies of Yahaya Bello, including im nephew, Ali Bello, and anoda defendant, for 2022.

However, on February 5, 2024, a week after im tenure as govnor expire, di EFCC amend di 2022 charges, raise am from 10 to 17 counts, and name Yahaya Bello as accomplice but not a defendant.

Di EFCC accuse Bello say e conspire wit Ali Bello, Dauda Suleiman and Abdusalam Hudu to convert more dan N80 billion wey belong to Kogi State to dia personal use, and dem commit di crime for September 2015.

Dis date na about four months before Yahaya Bello assume office as govnor for February 2016.

Di case still dey go on bifor Justice James Omotosho of di Federal High Court Abuja.

Meanwhile, di EFCC file one fresh case of 19-count charges against Yahaya Bello, bifor Justice Emeka Nwite of the Federal High Court, Abuja.

Dis new case dey very similar to di old one, but di date wey di crime dey committed, according to di EFCC na February 2016. E also name di same pipo as co-defendants.

Apart from di over N80 billion wey Mr Bello allegedly convert to personal use, di EFCC also allege say di former govnor bin conspire with one company for Abuja wey im name na E-Traders International Limited “to hide di aggregate sum of over N3 billion (N3,081,804,654) in account number 1451458080 domiciled in Access Bank Plc”.

Also, di same company allegedly help Bello “to transfer di aggregate sum of $570,330 to account number 4266644272 wey dey domiciled for TD Bank, United States of America”.

As di EFCC lay siege for im domot on Wednesday, Yahaya Bello release one statement wia e tok say di commission neva officially invite am for questioning over all dis allegations.

Bello also point to a court order by a Kogi State High Court for February 2024 wey prevent di EFCC from “harassing, arresting, detaining, or prosecuting” am pending di determination of a suit wey dem bin file for dat court.

“Na surprise say agency wey di main oga na lawyer go dey disobey court order anyhow,” di statement tok.

Also, di Kogi State goment bin don write to di EFCC and describe di corruption allegations against Yahaya Bello as ‘ridiculous and laughable,’ as dem tok say dia money no dey miss.

Source