Dis no be di end of di case – Sylvester Oromoni papa react to coroner inquest judgement wey free Dowen College from im death

Di papa of late 12-year-old Sylvester, student of Dowen College, Lekki, Sylvester Oromoni Snr, don fault di judgment of di Coroner Inquest wey tok say im son death na sake of negligence.

For one interview wit tori pipo afta di judgment, Sylvester Oromoni Snr bin reject di decision.

E say di medical experts no give concluding result on di incident.

“Medical experts no give concluding result. Dey say dem bin see one substance inside di body of di boy, and wetin be di substance?

E bin dey tested? E bin no dey tested. So dis no be di end of di case. As far as I dey concerned, e no represent di true procedure of di evidence dem take”, Sylvester Oromoni Snr tok.

‘Dem neglect di boy till im die’ – court tok wetin cause di death of Sylvester Oromoni

Di coroner wey chook eye into di death of 12-year-old Sylvester Oromoni, Magistrate Mikhail Kadiri on Monday tok say wetin kill Oromoni na death wey dey avoidable if to say di parents bin handle am well.

Tori bin burst for November 2021 say Sylvester die for Dowen College afta some seniors bin allegedly bully am as dem bin allegedly try to make am join cult.

Magistrate Kadiri say Sylvester no receive proper care wen di mata bin happun and na part of wetin lead to im death be dat.

Im add say di medical pipo too no try as dia negligence bin also contribute to di death of di young boy.

“Dem no carry am go hospital until di day wey di boy bin die for November 30 2021. Dey completely neglect di boy for a period wey pass 32 hours and im go through pain and suffer suffer,” di magistrate tok.

Two years afa di death of 12-year-old Sylvester Oromoni, im family announce burial plans for di pikin.

Im tori burst for November 2021 say Sylvester die for Dowen College afta some seniors bin bully am as dem bin allegedly try to make am join cult.

For statement from di family of di pikin, dem reveal say im burial go hold on Saturday 27 of January for Delta State wia dem finally bury am.

Dem further reveal say even wit all di media attention wey di mata bin get, di family neva get any justice on di mata.

Di statement describe di boy as veri intelligent and mature. E bin apparently get passion for computer science, programming electrical science and football.

Wetin bin happun for di Lagos inquest bifor

Father of late Sylvester Oromoni Junior tell court for Lagos state Nigeria say im bin treat im late pikin for house.

Late Sylvester Oromoni junior papa tok as witness for di coroner inquest wey dey hapun to determine wetin cause di death of di 11 year-old student of Dowen College Lagos State.

For one cross examination by counsel wey represent one of di student wey dem allege say get hand for late Sylvester killing, Godwin Omoaka, di witness bin tell di coroner court say im bin treat im son for house afta di family doctor tell dem say space no dey for hospital.

Lagos State goment set up di coroner inquest to find out wetin really kill di young boy.

On 14 March 2022, Doctor Clement wey dey work for Central hospital Warri, Delta State during di inquest say if to say na im handle di case dat time [wey im dey sick], e for do blood transfusion as last test result on di boy on November 30 show say im bin dey clinically ill and need close monitoring.

E use di opportunity to defend im original statement wey say na chemical intoxication cause di death, e say im give dat statement before di toxicology result rule out di first statement.

Dr Clement say im December 30 final autopsy report show say na pneumonia due to severe sepsis kill di young boy.

According to am, na for 2nd December 2021 police send am notice to come do autopsy on di deceased. By di end of di second week of December di results don ready, according to am.

As at wen e finish di autopsy, im say e no see anytin wey show why di young boy die. Di doctor say im also notice acute lungs injury for im bodi.

“I collect sample from di urinary bladder, blood from di heart, di lungs, di eye, di tongue and di liver sake of say if anytin pass through di mouth e go pass through di liver” na wetin Doctor Clement tok.

Police later call say di boy papa don report di mata for Lagos command and oda parties go need dey involved for di autopsy.

Di next pathologist come to Warri say dem go carry di bodi down to Lagos. Na so dem move di body to Lagos for second autopsy.

During cross examination, di magistrate Mikhail Kadiri ask am say “before you start to open di bodi, you see any trace of beating or trauma on di bodi”?

Di doctor wey be di 12th witness to come give evidence before di coroner answer “no, I only notice bruising for di lips, I no even see evidence of significant bleeding or blunt forced trauma”.

Dr Clement add say dem tell am say pipo beat di deceased but dem no tell am say dem give am substance to drink. Say na di papa supply information say di boy drink one kain substance.

Di doctor add say: “Wen I look im bodi, I no see any open injury, I suppose see evidence of bleeding for im abdominal cavity, but wen I open im cavities I no see anytin like beating”.

Lawyer to di Oromoni family Femi Falana ask di doctor during cross examination weda di boy fit don collect bruises before, di doctor say e dey possible, but add say im no see any ankle injury on di deceased as di second autopsy report from Lagos tok.

Wen di court ask am if e bin dey possible to cure di boy, di doctor reply say “apart from say I be pathologist, I be pastor too.

“I sabi pipo wey bin don collect best of care, but still die.”

Source