Di remains of make-up artist wey drown with Junior Pope dey re-buried for Akwa Ibom

Picture from di burial

Ubong Creativity David
Remains of late Abigail Frederick dey re-buried for her family home for Eket LGA Akwa Ibom State

Di family of di late make-up artist, Abigail Edith Frederick, wey drown with Nollywood actor Junior Pope for Anam community river for Anambra state don re-bury her remains for di family home for Ikot Udoma, Eket Local Goment Area of Akwa Ibom State.

Frederick die on Wednesday 10 April 2024 along with five oda film practitioners, wen dia boat capsize for River Niger.

Akwa Ibom state Governor Umo Eno, bin don visit di family over di weekend give order for dem to exhume her remains wey dem bin don bury by di bank of River Niger, so dem go return am for proper burial in di state.

Family dey receive di remains

Ubong Creativity David
Akwa Ibom state govnor bin order for her remains to dey exhumed and properly buried for dia hometown for Eket LGA
Candlelight procession for Frederick

Ubong Creativity David
Dem hold candlelight process in her honour before her burial

Di family bin first hold a candle-light procession in her honour, den di funeral service wey Church of Christ, Ikot Udoma conduct before dem bury her traditionally.

Reports say goment officials, Nollywood community, friends and sympathizers attend di burial.

Akwa Ibom State govenor offer support to Frederick family

Burial site

Ubong Creativity David
Di re-burial come on di order of Akwa Ibom state govnor

Akwa Ibom State Govnor Umo Eno bin don visit late Abigail Frederick family to tell dem sorry over di death of dia pikin.

Di govnor say, “dis dey deeply unfortunate. A young girl, 24 years old, wey just finish her National Youth Service Programme just last year, and decide to pursue her passion.

“Dis na reflection of our Arise Spirit. E show say our young pipo dey willing to go out dia, not to beg, not wait for handouts, but to pursue dia passions. Sadly, her life end di way e happen.

“Once I dey fully briefed, I decide to come here personally with di full complement of goment to console and encourage di family. Di goment go be with di family and support dem,” e promise.

Govnor Eno dey comfort di family

Akwa Ibom State Govt.
Akwa Ibom state Govnor Umo Eno pay condolence visit to di family

During im visit, di Akwa Ibom State govnor announce automatic employment for late Abigail Frederick elder sister into di state civil service.

For statement by Ekerete Udoh, di Chief Press Secretary to di govnor, e also direct im Senior Special Assistant on Humanitarian Services, Umo Ekpo to renovate di family house and bring am to modern standards.

E also assure of goment assistance to di two sisters wey still be undergraduates for University of Uyo wey di late make-up artist bin dey sponsor before her death.

Source