Mohbad: Naira Marley wan sue Iyabo Ojo, Punch Newspaper and odas for defamation – Lawyer

Popular Nigerian singer Afeez Fashola wey dey known as Naira Marley don begin legal action against actress Iyabo Ojo and oda pipo wey im accuse say dem publish damaging contents about am on di death of Mohbad.

Lawyer wey dey represent Naira Marley confam to BBC Pidgin di documents wey dey circulate say dem truly take legal against Iyabo Ojo and demand public apology wey she go post for her Instagram page.

Lawyer Ojo Olalekan say Iyabo Ojo bin allegedly defame Naira Marley ontop di death of Ilerioluwa Aloba wey pipo sabi as Mohbad.

Olalekan say Iyabo Ojo use her Instagram account to allegedly defame Naira Marley for September 2023 wey be di same month wey Mohbad bin die.

For di letter, Naira Marley claim say Iyabo Ojo accuse am of dealing wit Mohbad “spiritually, mentally and physically” and e say dis don expose am to ridicule for di public.

“Your publication for di internet wey dey readily accessible to users dey constitute a very serious libel and e don cause vey large damage to di reputation of our client (Naira Marley).”

“Since di publication (of Iyabo Ojo) our client don receive calls from his followers, colleagues, friends and fans all ova di world wey don read di post and dem dey express dia concern about di defamation wey you falsely post for your official instagram handle.”Di document read.

Naira Marley demand 500 million in damages

Olalekan say Iyabo Ojo need to publish a public apology to Naira Marley and it must dey posted on her Instagram handle ‘iyaboojofespris’ and national newspaper within seven days wey dem write di letter.

If afta di stipulated period Iyabo Ojo neva tender di apology, Olalekan say Naira Marley go dey forced to demand 500 million naira for damages.

“Our client dey propose say make you communicate your terms wey go help wit amicable resolutions within seven days wey dis letter come out or our client go begin legal proceedings without any consideration.”

‘We dey sue oda pipo’

Lawyer Olalekan tok say Naira Marley go also sue oda pipo sake of say dem join bodi spread damaging words against im client, Naira Marley.

E say Naira Marley go pursue di case go court sake of say dem dey label Naira Marley as pesin wey get hand for di death of im former signee Mohbad.

E add say Iyabo Ojo and Punch Newspaper don dey served wit pre-action notice and odas go recieve dia own on by Friday latest.

“Yes, we dey go court ontop dis issue. We dey sue oda pipo wey defame Naira Marley ova di death of Mohbad and e include, Punch Newspaper and Punch online News Columnist,” lawyer Olalekan tok.

For October 2023, di Nigerian police bin invite Naira Marley and Sam Larry for interrogation and investigation into di death of Mohbad. Dem later release Marley and Larry on bail afta dem apply.

Naira Marley na former boss of Mohbad wen e sign am to Marlians record. Marley don deny all accuse say im get hand for Mohbad death.

For one statement wey im release, Naira Marley tok say im also dey traumatised sake of di death of im former signee just like evri oda pesin dey traumatised.

Naira Marley tok say Mohbad bin leave di record label for September 2022 and add say di misunderstanding wey dem get no reach make dem wish di oda pesin death.

Meanwhile, di police neva release autosy result of Mohbad and di court don also postpone di coroner inquest on top di case till further notice.

Di death of Mohbad shake Nigeria and get di attention of pipo around di world.

Source