Psquare reconciliation: Paul, Peter Okoye dey back together, celebrate birthday afta 2017

“Two heads dey better than one”, na how Paul Okoye take pot im birthday message on Thursday as im an im twin brother Peter don reconcile.

Afta five years of gbas-gbos between di Psquare twin, dis insta video message show say dem settle dia gbege.

Psquare reconciliation

Di Psquare reconciliation dey come a day afta video comot wey show Peter, Paul and Jude Okoye as dem dey hug each oda.

Tori start to comot say dem fit don reconcile afta di pair follow each oda back for social media sometime last week.

Then Paul wife, post video wey show am dey carry both im and Peter pikin dem go shopping for America.

Even on Wednesday before dia video come out, Paul bin wish im twin broda, happy anniversary.

Na Nigerian singer J-Martins dey behind scenes dey make di moves for PSquare to come back togeda.

How Psquare fight take start?

Di wahala wey tori start to spread up and down for 2015, but na for 2017 everitin scata as video comot wey show di twins almost start to dey punch each oda.

Na for September dat year wia di group scata even as Peter reveal say e bin dey fear for di safety of im family.

Both of dem come start solo career as Paul take di name, Rudeboy and Peter go by Mr P.

Rudeboy bin release hits like Audio Money and Reason With Me while Mr P release hits like One More Night and Paloma.

Infact, around 2020, Paul call out Peter wife, Lola wen she wish di two of dem happy birthday, say wetin she dey do for back dey different.

But dem too don squash dia beef, with pictures wey comot yesterday dey show as dem dey hug each oda.

As to weda dem go come togeda to do song again, e dey remain to see.

Because di first time dem reconcile for 2016, dem release back to back bangers like Nobody Ugly, Away and Bank Alert.

Who be Psquare?

Di dancing and singing pop group Psquare bin appear for di Nigeria music scene for 2003.

De become popular as pipo begin dey hype dia dance style wey wan resemble Michael Jackson and Usher own.

For dia career, dem don drop seven album and different single releases with international collabo like Akon, Jermaine Jackson and Rick Ross.

Some of dia biggest hits na Busy Body, Do Me, Ifunaya and Break It.

Dem win many national and international awards wey include di 2006 Headies for Artiste of di year, Song of the year, Best R&B/Pop Album, and Best music video; Best Group awards for di MTV Africa Music Awards for 2008 and 2009.